Kellyanne Conway, Sarah Huckabee, Steve Bannon, Sean Spicer and odas wey resign, chop sack under Trump for White House

Kellyanne Conway don announce say she dey resign from her post as Senior Counsel to US President Donald Trump.

Inside one statement, Mrs Conway say she dey step down by di end of August to focus on her children, to give dem “less drama, more mama”.

Her husband George, wey be also pesin wey dey also criticise di president, go also step back from political activism.

She add for her statement say her decision na “completely my choice,” and say she go announce her future plans “in time”.

Di Republican strategist and veteran pollster, don serve for four years, dis one make her di highest-ranking woman for di White House. She be also di first woman to lead successful US presidential campaign, she contribute for Mr Trump successful effort for 2016.

Mrs Conway say her time for di White House come with blessings wey she no fit compare

As Senior Counsellor for di White House, Mrs Conway act as political advisor to President Trump and maintain ogbonge position for di administration.

Kellyane Conway

EPA

Di past four years don give me blessings beyond compare,” she tok inside statement.

“[George and I] dey disagree about plenty but we dey united on wetin matter di most: di kids,” she tok.

“Our four children are teens and tweens wey dey start new academic year, dey middle school and high school, remotely from di house for at least a few months,” Mrs Conway tok. “As millions of parents nationwide know, kids wey dey ‘do school from home’ require one kain level of attention and vigilance wey dey as unusual as dis times.”

Di announcement dey comes hours afta Mrs Conway daughters, Claudia, tweet say her mama job don “ruin [her] life” – message wey later go viral.

Mrs Conway na one of President Trump strong supporters, but na controversial figure for long time.

She no be di first pesin to resign or chop sack for Trump administration.

Steve Bannon

Steve Bannon

Reuters

Steve Bannon bin work as Chief Strategist for di Trump Campaign and dem fire am for August 18, 2017.

Di sack come afta Trump comment on di Charlottesville riots. Dem recently arrest Steve Bannon say im bin get hand for wuruwuru wey happun to di money dem get from charity for di purpose to to build Donald Trump wall.

Hope Hicks

Hope Hicks

Getty Images

Hope Hicks bin work as di White House fourth director of strategic communications. Madam Hicks spend three years with Trump for in campaign and presidency.

She resign one day afta she tell congress say she bin don tell “white lies” for her oga. Tori be say afta she comot White House, she start to dey work as chief communications officer for Fox Corporation.

Jeff Sessions

Jeff Sessions

Getty Images

Jeff Sessions bin work with di Trump Administration as di Attorney General.

Afta one year nine months with Donald Trump, Sessions comot afta Trump start to dey give am heat on top say im wash hand comot di investigation on top weda Russia bin get hand for Trump campaign.

Sarah Huckabee Sanders

Sarah Huckabee Sanders

Getty Images

Sarah Sanders serve for di office of di Press Secretary afta Sean Spicer bin comot. She work for di Trump administration for almost two years.

Although e no clear why she resign, for her time as press secretary, accusations bin dey say she bin dey lie to reporters. As at now, she be contributor for Fox News and dey active for conservative groups.

Sean Spicer

Sean Spicer

EPA

Sean Spicer bin start off for di Trump administration as Press Secretary, e comot office afta only six months afta dem hire oga Scaramucci to do di work we already dey do.

Spicer currently dey work for di Navy, e be published author and comot as contestant for di TV show, Dancing With The Stars.