Chelsea sign Joao Felix as Conor Gallagher join Atletico Madrid: All di football transfers wey you suppose know dis season

Joao Felix and Conor Gallagher

Getty Images

Chelsea don complete signing of Portugal forward Joao Felix from Atletico Madrid for a fee of £45m.

England midfielder Conor Gallagher don also sign from Chelsea go Atletico Madrid for about £33m.

Felix wey be 24 years old bin sign a seven-year deal to begin for Stamford Bridge.

Di player bin score four goals for 20 appearances during a loan for west London for 2023.

Dis go be di third summer transfer window since di takeover of di owners Behdad Eghbali and Todd Boehly since 2022 wey Chelsea don spend more dan rival clubs to sign players.

Chelsea don spend more dan £1.5bn on transfers since di takeover.

Di club bin sign Pedro Neto for £54m on Sunday to make am 11 summer signings afta dem don spend £185m since June 14.

Dis signings don make di blues squad reach more dan 50 senior players as di £35m deal to add Atletico Madrid player Samu Omorodion to di team no dey successful.

Di signing of Felix don increase dia spending dis summer.

“I dey really happy to dey back for Chelsea and I no fit wait to start,” Felix tok.

“I fit see some familiar faces from di last time wey I dey here, wey dey always nice.”

Meanwhile, Gallagher bin sign a five-year contract wit di Spanish top-flight club.

Gallagher bin join Chelsea at di age of six and continue to make 90 appearances, scoring 10 goals.

Gallagher enta di final year of im contract for Stamford Bridge so Chelsea bin sell am so dem go avoid to lose am to free transfer next summer.

“To everyone for Chelsea, I tank una for making my dreams come true,” Gallagher write for Instagram.”

“Na honour evri time I wear di shirt, and na dream come true to captain di team for many occasions.

“I love evri moment. Dis memories go last forever. I appreciate all di love and support from di fans.”

E don win 18 England caps since e make im debut for 2021 and e dey part of England squads for di 2022 World Cup and Euro 2024.

Oda signings wey don happun

Alvarez, Neto and Calafiori

Getty Images
  • Pedro Neto- Cheslea

Chelsea bin complete a £54m move for Wolverhampton Wanderers forward Pedro Neto.

Di 24-year-old bin sign a seven-year deal wit di Blues until 2031.

  • Julian Alvarez

Atletico Madrid bin complete di £81.5m signing of Manchester City striker Julian Alvarez on a six-year deal.

Di 24-year-old na record sale for City, wey pass di £50m dem receive from Chelsea for Raheem Sterling for 2022.

  • Oliver Skipp – Leicester City

Leicester bin sign midfielder Oliver Skipp from Tottenham on a five-year deal for a fee wey pass £20m.

Di 23-year-old wey come through Tottenham academy bin make 77 Premier League appearances for di club, including 21 last season.

  • Cameron Archer – Southampton

Southampton bin sign striker Cameron Archer from Aston Villa for £15m.

  • Lesley Ugochukwu – Southampton

Southampton bin sign Chelsea midfielder Lesley Ugochukwu on loan.

  • Matthijs de Ligt and Noussair Mazraoui – Man United

Manchester United sign Bayern Munich pair Matthijs de Ligt and Noussair Mazraoui for one move wey cost almost £60m.

  • Aaron Wan-Bissaka – West Ham

West Ham United sign defender Aaron Wan-Bissaka from Manchester United for £15m.

  • Fabio Carvalho- Brentford

Brentford sign winger Fabio Carvalho from Liverpool in a deal worth £27.5m including oda additions.

  • David de Gea

Italian side Fiorentina bin sign former Manchester United keeper David de Gea.

Di 33-year-old spend last season on di sideline afta im contract for Man United end for 2023.

  • Boca Juniors – Chelsea

Chelsea complete din signing of Boca Juniors defender Aaron Anselmino in a £15.6m deal.

  • Riccardo Calafiori

Arsenal bin sign Italy defender Riccardo Calafiori from Bologna for a fee of up to £42m including addition.

Source