Wia Killaboi dey since police gbab am for Sierra Leone?

Di tori of Benjamin Best Nnanyereugo aka Killaboi neva end since wen di tori of how e allegedly kill im girlfriend bin enta public space for 2023.

Killaboi na di boyfriend of 21-year-old Onuwabuagbe Augusta Osedion wey be student of Lead City University, bifor argument bin happun between dem.

Di police confam say di mama of di deceased girl bin report on Saturday 15 July say her pikin tell her say she bin quarrel wit her boyfriend on Tuesday 11 July.

Wen dem go Killaboi house for Ajah area of Lagos state, dem recova Augusta Mercedes Benz C30 but dem no fit access di apartment.

Di tok-tok pesin for di Lagos Police Command SP Benjamin Hundeyin say DPO of Ajah police station lead detectives to di scene and dem break di door and discova di lifeless body of Augusta.

Police confirm say Augusta private part bin dey miss wen dem find her lifeless body and e don dey rotten.

Meanwhile, Killaboi bin confess for im Instagram story say e and im girlfriend bin get argument and im mistakenly stab her to death.

Dat time, Killaboi even say im go surrender to di police and face di consequence of im action.

Dem carry di body of late Augusta go General Hospital Mortuary for Yaba for autopsy and preservation.

Since dat time, new tori neva comot.

Killaboi dey Sierra Leone?

Na Cordelia Okonye, di mama of late Augusta (di victim) wey her boyfriend bin allegedly kill bin narrate how dem arrest di suspect for Sierra Leone for 2023.

Wen di mata happun for 2023, tori show face say Killaboi don run comot for Nigeria.

As part of investigation and efforts to arrest Killaboi, di Lagos State Police Command on 10 October 2023 bin declare 26-year-old Killaboi wanted afta accuse say im allegedly kill im 21-year-old girlfriend and student of Lead City University.

For October 2023, Lagos police tok-tok pesin Hundeyin say di Sierra Leonean police na dem gbab di suspect and di next tin na to extradite am come Nigeria.

SP Hundeyin tell BBC News Pidgin for October 2023 say, “We fit confam say police for Sierra Leone don arrest di suspect and we dey work wit dem to extradite am come Nigeria”.

But since den, nobody don hear any mata ontop di case.

Escaped? Wia Killaboi dey?

For Wednesday 21 August, 2024, BBC Pidgin bin reach out to Cordelia Okonye, di mama of late Augusta (di victim) to hear tori of wetin be di latest update ontop di case of di justice for her daughter.

Di mama say she confam say Killaboi don escape from di prison for Sierra Leone. She say notin dey happun ontop di case and nobody dey find di whereabout of Killaboi.

Mrs Okonye say Killaboi bin escape from Sierra Leone for 26 November, 2023 wen dem report say some armed pipo attack di prison.

“I get pesin for Sierra Leone, as di tin dey happun for dat 26 November 2023, e dey forward di video of di prison break give me.”

She say di Sierra Leonean IGP bin say “na handover dem wan do and no be extradition and im bin dey concerned say Nigeria Police no come make dem do di hand-over”.

“Wen di mata happun, di IGP for Sierra Leone stop to dey pick my call and chats. Na through my lawyer we push to know wetin happun and dem kon tell am say dem write to Nigeria say e (Killaboi) don escape from prison,” Mrs Okonye tok.

Di mama lament say her late daughter na her “sunshine” wey she don raise from small wen her papa allegedly abandon both of dem and her death dey painful.

She add say wen dem find say Killaboi dey Sierra Leone, dem gada money go meet police for dia to make arrest but now di suspect don escape and police no tell dem anytin.

“Nigeria Interpol tell my lawyer say e (Killaboi) don escape and till now dem no make any public statement to dat regard,” Mrs Okonye tell BBC Pidgin.

Mama of di deceased tok say na wen she bin write say Killaboi no dey for Sierra Leone, she kon dey get pipo dey tok about am and blame her say why she make am public.

Mrs Okonye say dem no know wia di suspect wey allegedly kill her daughter dey and nobody give her any update since den.

Di question now na wia dis suspect dey since Nigeria police bin declare am wanted?

Prison break bin happun for Sierra Leone?

For 26 November, 2023, Armed men bin attack a military barracks and a prison for Freetown, di capital of Sierra Leone.

Di BBC report say several current and former military officials dey involved and e raise di possibility say na attempted military coup.

During di prison attack, some inmates run comot for di prison but e dey unclear dat time how many prisoners dem release.

Videos wey go viral for social media show wia several pipo bin dey waka from di area of Freetown Central Pademba Road prison.

President Julius Maada Bio of Sierra Leone later even say most of di leaders wey dey behind di attack don chop arrest.

Dem declare curfew for Sierra Leone wen di attack bin happun, but dem later lift di curfew.

Dis mean say truly, prison attack bin happun for Sierra Leone during dat period of November 2023.

Police tok

For Wednesday 21 August, 2023, BBC Pidgin bin also reach out to di Lagos Police Command wey declare Killaboi wanted to know wetin be di latest ontop di case.

According to di Lagos State tok-tok pesin Benjamin Hundeyin, update no dey ontop di tori as at dis moment.

BBC Pidgin don also reach out to di Sierra Leonean police through dia mail to hear from dem but dem neva respond as at wen we write dis tori.

Wetin happun bifor

Police for Lagos, southwest Nigeria bin say dem dey investigate di death of 21-year-old Onuwabuagbe Augusta Osedion wey her boyfriend Benjamin aka Killaboi confess say na im kill am.

For series of updates for Killaboi Instagram story for 2023, e also share screenshots of di message im send to di girl mama wia e tok say im no intend to kill im girlfriend.

According to Hundeyin, Augusta mama say she bin make effort to reconcile di two lovers but she no dey able to reach dem on dia phones or oda platforms.

Mrs Okonye bin tell di police say she reach di daughter roommate and di lady lead dem to di boyfriend house for Oral Estate for Ikota, Ajah, wia dem recova her daughter Mercedes Benz C30 and dem no fit access di apartment but di police force dia way enta.

SP Hundeyin add say dem see marks of violence and signs of struggle for di body of di victim.

E say dem also recover one note wey Benjamin put for di scene and dem dey treat am as exhibit.

Result of di autopsy no reach di public and nobody don confam di whereabout of Killaboi.

Source