Malik B Roots: Who be Malik Abdul Basit, member of the Root band wey die

Malik Abdul Basit, one rapper, singer and founding member of The Roots, don die. According to one statement ontop di group verified Twitter account.

He die at di age of 47.

Di band announce im death on Wednesday for Instagram inside post wey feature picture of Malik with The Roots’ co-founders Black Thought and Questlove.

“Na with heavy hearts and tearful eyes we regretfully infor you of di passing of our beloved brother and long time Roots member Malik Abdul Basit”. Di post tok.

https://www.instagram.com/p/CDPLAtJAFr7/

Di statement no tok how e die.

Who b Malik B?

Di rapper Malik B, wey e full name na Malik Basit come from Philadelphia and join The Roots small time afta im fellow rapper Black Thought and drummer Questlove found di group for di late 1980s.

E be longtime member of di hip hop group wey base for Philadelphia from dia early beginnings to around 1999 wen e comot di group afta e appear for di first four albums of di group.

Basit go on to produce im own solo material.

Malik solo career no too ginger like im work with The Roots. E release di solo album Street Assault for 2005, followed by im Psychological EP for 2006.

E oda work na di 2015 collaborative album Unpredictable, wey e do with DJ and producer Mr. Green.

Several years afta im departure, e also appear for several tracks ontop Roots albums. On 2006’s Game Theory and two tracks on 2010’s Rising Down.