Edo State House of Assembly: Govnor Godwin Obaseki clash police, accuse Adams Oshiomole, Hope Uzodima of attempt to ‘take over im government’

Edo State House of Assembly

BBC

Govnor Godwin Obaseki on Thursday order and remove di roof of Edo State House of Assembly make nobodi do sitting afta di govnor kwanta wit police team wey attempt to take over di Chief Anthony Enahoro Complex.

Before e order contractors to turn di Assembly complex for Creek Road to renovation project site, govnor Obaseki bin don pursue police officers wey bin take over di building of di Edo State House of Assembly wey dey di state capital, Benin.

Di govnor tell BBC Pidgin through im tok tok pesin Crusoe Osagie say na attempt by some big politicians including a govnor of anoda state to take over di Edo State House of Assembly and cause gbege for im goment ahead of di 19 September, 2020 Governorship election for di state.

According to di Edo State Govnor: “Na attempt by Adams Oshiomole and some members of di APC, including di governor of Imo state Hope Uzodinma.

“Dem dey try use force to seize control of di House of Assembly complex wey currently dey under renovation and reconstruction.

“We hear say dem go do fake mace somewhere and use am storm di House of Assembly wey no dey function right now sake of renovation, to illegally inaugurate parallel House of Assembly for di state on Thursday morning..

Di speaker of di House of Assembly, di Deputy speaker and di Governor of di state bin come here dis morning to spoil di plan.We wan prevent any crisis, na why we dey raise alarm so dat di presidency, security agencies, even di Inspector General of Police fit no dey aware of wetin dey happen.”

Govnor Godwin Obaseki call on di presidency and security agencies to call dis pipo to order and prevent any death.

Im say govnor Obaseki dey disappointed say pipo wey suppose be elders go fit try cause dis kain katakata.

For about two months now, di members of di House don dey do dia meetings for di old legislative chambers for Benin. Di Special Adviser to di Govnor ontop Media and Communication Strategy, Crusoe Osagie wey bin follow BBC Pidgin tok on behalf of di Govnor, accuse Oshiomhole heavy accuse say na im dey behind di attempted take over.

Govnor Godwin Obaseki dey lie o! – Adams Oshiomole

Oga Oshiomhole tok tok pesin Simon Egbegbulem tell BBC say all wetin Govnor Obaseki dey tok no be true. “Oshiomole no get hand inside wetin dey happun for Edo State House of Assembly.”

“Im no get bizness, im no be lawmaker, e no dey inside di Assembly, e dey far away from im village inside Iyamor wia im dey campaign for im party for di coming election and e no get bizness wit wetin dey happun in di assembly.”

Wetin dey really happun for di assembly, (I tink di govnor just dey lie) na say… you know say we get 24 member house of assembly, and 20 of dem na APC members, then you get four PDP members and as you dey aware, di govnor don waka go PDP. Egbegbulem add.

Di former national chairman of Nigeria ruling APC wey also be native of Edo State, but e neva respond to all di accuse.

Edo State House of Assembly

BBC

Tori be say di govnor and di speaker of Edo State House of Assembly on Thursday prevent wetin for me by force take over of di assembly complex.

Na early morning na im a group of police men and some members of di House of Assembly wey dem never still swear in, waka visit to di Chief Anthony Enahoro Complex, na dia crowd of supporters ga block di city centre.

Shortly afta di govnor leave di Assembly complex, construction trucks drive into di assembly gate begin deliver stones and sands for di main gate.

Di speaker wey bin escort di govnor also give instruction of no entry into di Assembly complex.

Edo State House of Assembly

BBC
Trucks dey move in sands and stones to di assembly entrance while di speaker and di deputy govnor dey supervise
Pipo wey hold placards

BBC

For now, all appears calm wit supporters wey dey rejoice as dem dey see payload of sand and stone delivered to di troubled assembly complex.

Dis incident dey come shortly afta di state members of Assembly bin impeach di Deputy Speaker of di House, Yekini Idiaye. Dem bin replace Idiaye wit Roland Asoro, one lawmaker wey dey represent Orhionmwon II Constituency.

Edo State House of Assembly

BBC
Edo State House of Assembly roof na im di pipo wey di govnor bring dey remove on Thursday morning so that no sitting fit hold. But di Govnor office tell BBC Pidgin say di work men go to renovate di Assembly complex. And say di lawmarkers don move go di old Assembly complex.
Edo State House of Assembly

BBC

Some videos and foto bin show heavy police presence inside di State House complex on Thursday, August 6, wit patrol moto car dey blast siren.

Even though Gov. Obaseki don waks from APC join PDP Edo state matter to APC

Politics na game of numbers and every state dey to any political party.

For Nigeria ruling All Progressive Congress party, di more states wey dem get to govern, di more power wey dem go fit enjoy on top different states.

Until Edo state governor Godwin Obaseki bin resign from APC on June 16, 2020, di party bin dey control 21 states while opposition Peoples Democratic Party bin dey im charge of 15 states.

As govnor Obaseki register as PDP member on Friday June 19, e mean say di party now get 16 states, at least till di September 19 happun.

On top of dat, Edo na di only state wey APC bin fit get for South-South Nigeria afta di 2019 govornorship election for Nigeria.

We still dey chook eye for dis tori, make you dey refresh dis page for more updates.