Nigeria vs Ivory Coast – Afcon final preview

Nigeria vs Ivory Coast Afcon final

Getty Images
Dis na di second time for di tournament wey dis two kontris dey face each oda

Nigeria go jam di hosts Ivory Coast for di Africa Cup of Nations final on Sunday evening.

Di Super Eagles beat South Africa for penalty shootout for di semi final to reach di final.

Kelechi Iheanacho na im score di winning spot-kick to give im kontri victory.

For di host nation, di journey to di final bin no smooth at all.

DI Elephant sack dia manager Jean-Louis Gasset afta dia 4-0 defeat to Equatorial Guinea wey almost send dem out of di competition.

But dem manage to squeeze dia way through di best third-place team before dem knock out holders Senegal and den Mali.

Sebastien Haller score di only goal of di game as Ivory Coast beat DR Congo for di second last-four meeting on Wednesday night.

Kick off time for di Afcon final na 8:00pm West African time and na for di Alassane Ouattara Stadium for Abidjan dis match go take place.

Di last time wey dis two teams meet for di group stage na Nigeria win 1-0, Troost Ekong score di goal from penalty kick.

Nigeria vs Ivory Coast team news

Victor Osimhen dey fit to lead Nigeria attack against Ivory Coast afta im issues wit im belle wey make am no travel without di squad.

Nigeria on-field captain William Ekong say im dey expect Sunday Final between di Eagles and di Elephants to be classic.

“E no go be tea party, and we no go go dia wit tea cup. We go work hard and fight hard for di trophy.” Ekong tok.

Jose Paseiro on Ahmed Musa e say: “Ahmed Musa na special and important pesin to di team. Im be my assistant, im dey advise me, Im dey give me di necessary support. Im dey committed for im role and im fit play. We go wait and see tomorrow, but we wan win di Afcon for Musa to lift di trophy.”

Emerse Fae Ivory Coast manager say “Di fact say Nigeria don beat us na good tin because we know who we dey up against. Di kain way wey we prepare for di match wit our players dey critical. I feel say Super Eagles and us dey di same level.

“We get great opportunity tomorrow; we dey 90 minutes away from adding a third star for our Ivorian jersey. Di teams dey equal to di task, psychologically. As di competition progress, di Nigerian team don gain strength. Our journey bin dey very difficult journey for di beginning, but we gain momentum from di round of 16 against Senegal.”

“Like any high-level match, like any final, e go come down to di details. We go dey patient. We no go rush. We go focus on starting di match well and dey patient to unsettle dem.”

Source