Manchester United footballer Mason Greenwood dey charged wit attempted rape and assault

Mason Greenwood

PA Media

Manchester United footballer Mason Greenwood don dey charged wit attempted rape, engaging in controlling behaviour and assault, di CPS tok.

Prosecutors say di charges relate to di same complainant.

Di 21-year-old footballer go face im first court appearance for Greater Manchester Magistrates’ Court on 17 October, di CPS add am.

Janet Potter, from Crown Prosecution Service North West, say dem don authorise Greater Manchester Police to charge Oga Greenwood wit attempted rape, engaging in controlling and coercive behaviour, and assault wey dey cause actual bodily harm.

Dem say di alleged rape happun on 22 October 2021, while di alleged assault take place last December.

Di charge of controlling and coercive behaviour relate to one period of time since November 2018.

Ms Potter say dem make di charges afta specialist rape prosecutors review one file of evidence from police.

She added: “Di Crown Prosecution Service remind all concerned say criminal proceedings against di defendant dey active and say e get right to a fair trial.

“E dey extremely important say make no reporting, commentary or sharing of information happun online wwey wey fit in any way affect di proceedings.”

Earlier on Saturday, dem arrestdi Manchester United footballer for allegedly breaching bail conditions.

Im bin chop arrest on suspicion of rape and assault for January. Dem also question am about claims of making threats to kill.

Di BBC understands say dem make di latest arrest for im home for Bowdon, Greater Manchester.

For one statement, one representative for Greater Manchester Police say dem dey “aware of one allegation regarding one 21-year-old man breaching im bail conditions and dem make arrest on Saturday”.

Dem add am say “enquiries dey go on at dis time”.

Within hours of di online allegations for January, dem suspend Greenwood from playing or training wit im club until further notice.

Nike end im sponsorship deal wit am and Electronic Arts remove am from active squads on im Fifa 22 game.

Di rape claim wey land Greenwood im first arrest

Police arrest Mason Greenwood on suspicion of rape and assault for January.

Greater Manchester Police say dem hear about di “social media images and videos wey one woman post wey report incidents of physical violence”.

Di woman bin post pictures and videos of di allegation for her Instagram story wey she caption: “To everyone wey wan know wetin Mason Greenwood actually dey do to me”.

She later delete di post.

Mason Greenwood never respond to di allegations.

Meanwhile, Manchester United say dem dey aware of di allegations

Di club add say, “Manchester United no dey condone violence of any kind.”

Later Manchester United say Greenwood no go return to training until further notice.

Greenwood wey United promote from dia academy make im debut for march 2019. Im don make 129 appearances for Manchester United and don score 35 goals.