Wetin to know about di Indian tycoon ogbonge wedding wey Nigerian musician Rema show for

Ambani wedding

Reuters
Anant Ambani dey marry im long-time girlfriend Radhika Merchant dis weekend

Celebrities from across di world don land Mumbai for di wedding ceremony of di youngest son of Asia richest man Mukesh Ambani dis Friday.

Anant Ambani, wey be di son of Reliance Industries chairman Mukesh Ambani, go marry Radhika Merchant, wey be di daughter of pharma tycoons Viren and Shaila Merchant.

Di four-day ogbonge wedding for Mumbai city na di final stop for di series of lavish party dem wey di family don dey host since March.

Ahead of di ceremony on Friday, heavy rain fall well-well for di city, some parts dey flooded.

Anant papa Mukesh Ambani, wey be 66 years, presently na di10th richest man for di world .

Im net worth na $115bn, according to Forbes. Mukesh papa na im be di founder of di Reliance Industries, im start di business for1966, na very big company wey dey operate for sectors ranging from petroleum and retail, to financial services and telecoms.

Anant na di youngest of Mukesh three children, all of im children dey di board of Reliance Industries. Di 29-year-old dey involved in Reliance energy businesses and im dey di board of Reliance Foundation.

Dis na all you need to know about di ogbonge wedding for India.

When be Anant Ambani wedding?

Di couple go marry for traditional Hindu ceremony on Friday, 12 July 2024, for di Jio World Convention Centre.

Afta di wedding ceremony, tori be say di family go host ogbonge reception throughout di weekend, before one final reception for dia household staff on Monday.

Key roads for di city dey closed for several hours a day until Monday wey di Party (owambe) go end.

Mumbai police dey label di wedding as “public event” since several international and Indian VIPs dey attend, according to tori pipo Reuters news agency.

Bill Gates and Paula Hurd pose during the pre-wedding celebrations of Anant Ambani

Reuters
Bill Gates and Paula Hurd pose during di pre-wedding celebrations for March

Who dey attend di wedding

Priyanka Chopra and Nick Jonas

Reuters
Actor Priyanka Chopra pose outside Mumbai airport wit her husband singer Nick Jonas

From former prime ministers, business moguls, celebrities all dey di guest list for di ogbonge wedding.

Reality TV star Kim Kardashian, former UK PM Tony Blair and Nigerian rapper Rema dey among those wey dey India financial capital to attend di ceremony.

Mumbai police dey label di wedding as “public event” since several international and Indian VIPs dey attend, according to tori pipo Reuters news agency.

Rajan Mehra, CEO of air charter company Club One Air, tell Reuters say di family rent three Falcon-2000 jets to ferry wedding guests to di event.

“Di guests dey coming from all ova and each aircraft go make multiple trips across di kontri ,” e tok .

But di restriction don also bring plenty tok-tok – pipo wey dey live for di city dey complain of traffic, while oda have questioned the ostentatious display of wealth at the seemingly never-ending celebrations.

tori dey fly up and down say Adele fit perform for di wedding, but di family neva confam dis.

Na for March di family begin di wedding festivities, dem hold three-day pre-wedding party for dia home state of Gujarat.

Among di 1,200 guests wey bin attend di celebration na international celebrities, politicians, and members of di business world – including Meta Mark Zuckerberg and Microsoft Bill Gates.

Di party bin start wit performance by Rihanna on di first night. Diljit Dosanjh, di first Punjabi singer to perform for Coachella, climb stage on di second night, while rapper Akon close di show on di final day of celebrations.

How much Ambani wedding cost?

Di Ambanis neva reveal how much dis wedding go cost dem but wedding planners dey estimate say dem don already spend anywhere between 11bn and 13bn rupees [$132m-$156m].

Tori be say dem pay Rihanna $7m (£5.5m) for her performance, while dem claim say Bieber money fit reach $10m.

Ambani children also do ogbonge pre-wedding festivities. Hillary Clinton and John Kerry bin dey among attendees for Isha Ambani pre-wedding bash for 2018, wey feature performance by Beyoncé. One year later, Akash Ambani pre-wedding bash feature performance by Coldplay.

Fotos of celebs for Ambani wedding

Source