Rescue operation dey go on as school wey collapse for Jos trap several students

School building collapse in Jos

BBC
Rescue operations dey go on for Saint Academy for Gana Kafiyu, Busa Buji for Jos North Local Goment Area of Plateau State.

Rescue operations dey go afta one two-storey building wey dey house one school collapse on Friday morning for Plateau State, north central Nigeria.

Di building collapse wen school bin dey in session and wen class bin dey go on.

According to NEMA, di incident happun for Saint Academy for Gana Kafiyu, Busa Buji for Jos North Local Government Area of Plateau State.

E neva clear how many pipo don die but several students don die and injure, according to di National Emergency Management Agency (NEMA).

Security agencies and rescue operators dey use excavators to rescue students and teachers wey dey under di rubbles.

BUILDING COLLAPSE SAINT ACADEMY IN GANA KAFIYU, BUSA BUJI, JOS PLATEAU STATE

A 2 Storey building housing Saint…

Posted by National Emergency Management Agency (NEMA) Nigeria on Friday, July 12, 2024

‘I dey opposite di school wen I hear loud sound’

Meanwhile eyewitnesses for di area Samuel Akpan narrate to BBC News Pidgin how di building collapse take happun.

Samuel wey be one of di eyewitness wey joinbodi wit odas to rescue pipo bifor officials come tok say im bin dey for one shop wey dey opposite di school wen im hear loud sound.

“Wen I hear di big sound I say wetin dey happun, I kon see say di two-storey building don collapse and students dey inside dey write exam, we run go dia to see wetin dey happun, but we no really know wetin to do in di first place, I no even know how to take call dem [ emergency services], no tools to work wit, wey gatz to wait bifor goment pipo begin come.”

Im say dem rescue some pipo wit dia small small tools and di pipo wey dem rescue dey alive but dia small small tools no dey enuf.

Im add say pipo still dey trapped under di rubbles but im dey hope say evritin go dey okay.

‘Di building sink’ – Eyewitness

School wey collapse for Jos, north central Nigeria

BBC

Anoda eye witness wey identify imsef as MC Iwitness tell BBC Pidgin say na sink wey di building sink enta ground.

“I dey see posts online about di building collapse na im I run reach here, di main story be say di building no collapse but e sink. Di students wey dey Junior Secondary School [JSS ] 1 and 2 wey dey down floor, dey under di rubble and di ones wey dey upstairs na dem bi di major casualties now,” di eyewitness explain.

Im add say from wetin dem don see so far rescue operations still dey go on , Army, Police, Civil Defence, Road Safety and oda agencies dey on ground dey go di rescue operations.

“Individuals sef dey join hand for di rescue operations, one young guy wey be one of di first responders faint at some point sake of di dust. Some students dey trapped under di rubble, four excavators dey on ground we hope say di children go come out alive and well.” im conclude.

We dey update dis tori

Some fotos from di school building wey collapse

School building collapse in Jos

BBC
Pipo watch as rescue operations dey go on
School wey collapse for Jos, north central Nigeria

BBC
School wey collapse for Jos, north central Nigeria

BBC
School wey collapse for Jos, north central Nigeria

BBC
Pipo gada near di school compound

Source