Ugandan athlete Rebecca Cheptegei ex-lover Dickson Ndiema don die

Uganda athlete Rebecca Cheptegei ex-lover Dickson Ndiema don die for di Moi Teaching and Referral Hospital for Eldoret.

One hospital official confam say Ndiema die on Monday night for di ICU wia dem admit am.

E die some days afta Cheptegei die for di same hospital.

Dickson Ndiema bin attack di marathon runner as she dey return home from church more dan one week ago, before e baff her wit petrol and set fire on her body.

Local administrators tok say di two bin get kasala sake of one small piece of land for north-west Kenya, wia Cheptegei bin dey live and train.

Ndiema die on Monday night for di intensive care unit wia dem bin admit am wit more dan 30% burns.

“Na true say e die from di [burn] injuries,” Dr Owen Menach from Moi Teaching and Referral Hospital tell BBC.

Ms Cheptegei die last Thursday from 80% burn she sustain during di attack.

Neighbours tell BBC say dem bin hear screams before Cheptegei begin dey run towards dem and dey shout for help.

Ndiema suppose face charges as police tok say dem dey treat Cheptegei death as murder, and de name di former boyfriend as di main suspect.

Dem admit di both of dem for Moi Hospital in Eldoret bifor dia deaths.

Di 33-year-old athlete na di third athlete wey dem go kill for Kenya for di last three years, wia police name dia intimate partners as di main suspects.

Dem born di Olympian for di Kenyan side of di Kenya-Uganda border, but she chose to cross ova and represent Uganda to chase her athletics dream wen she no get breakthrough for Kenya.

Wen she begin get into athletics, she join di Uganda People’s Defence Forces for 2008 and she rise to sergeant rank.

Her career include competing for dis year Paris Olympics. Although she come 44th for di marathon. Pipo for her home area dey call her “champion”.

She also win gold for di World Mountain and Trail Running Championships for Chiang Mai, Thailand, for 2022.

Attacks on women don become major concern for Kenya.

For 2022 at least 34% of women say dem bin experience physical violence, according to one national survey.

Family confam di burial of Uganda athlete Rebecca Cheptegei

Dem go bury Cheptegei on Saturday, 14 September, for Uganda. She go receive military burial.

Her papa, Mzee Joseph Cheptegei, confam say di deceased na member of di Uganda People Defense Forces (UPDF) and na why dem go lay am to rest wit full military honours.

E say dem dey work wit both di Kenya and Uganda goments to ensure dem give am a befitting send-off at Bukwo, wey dey di Eastern part of Uganda.

Dem carry out post-mortem on di bodi of Cheptegei for di hospital on Wednesday.

Source