Wetin dey cause teachers strike for Kenya as schools plan to resume

Teachers in Kenya

Getty Images

Teachers for Kenya dey divided ova dia plan to go on strike wey suppose start today Monday 26 August.

Kenya National Union of Teachers (KNUT) and Kenya Union of Post-Primary Education Teachers (KUPPET) no gree for each ova di strike as one pull out of di strike while di oda say dem go carry on.

Di two teachers union bin don ready to begin strike on Monday, 26 August, ova wetin dem mention as poor treatment for dia members.

However, KNUT pull out comot from di strike.

Di strike, according to di teachers, na sake of delayed promotion and dia working conditions.

Dis strike dey come for period wey schools for Kenya dey prepare to resume back to class for third term afta a long period.

Around May 2024, president of Kenya Williams Ruto bin announce further postponement of school children resumption for di kontri.

Di president tok am for di national address wey im give dat time for di kontri capital, Nairobi, say second term school reopening go dey postponed.

According to President Ruto, schools for Kenya go dey closed till further notice sake of di serious flooding wey affect di kontri.

But later, di schools resume and students go back to class to complete dia second term.

Again, anoda gbege dey show face as di school children wan resume for third term.

How di strike gbege take waka

KUPPET wey dey in charge of education afta primary school and dia national governing council bin hold important meeting for Sunday.

During di meeting, local media report say 68 members of di union bin vote say make di strike happun.

Di Teachers Service Commission (TSC) for Kenya bin meet wit di union but e no lead to any result wey favour KUPPET.

Wetin di teachers dey demand

Di union dey demand beta payment for di teachers, dem dey also ask make goment do somtin ontop di delayed promotions wey teachers dey experience and also beta working conditions.

KUPPET say dem no dey back down from di strike and all di teachers gatz participate.

“Kuppet wish to inform members and all teachers at large say di strike from Monday cova all teachers wey dey public service,” Kuppet Secretary-General Akello Misori tok.

Di union also want make goment employ intern teachers on permanent terms and put dem for pension.

“We want make di goment also review our career progress bifor we go resume work,” di union tok.

Di strike dey take effect?

KUPPET don dey on di street of Kenya dey demonstrate as dem no back down on di strike to press down dia demands, local media dey report.

Na Kuppet Uasin Gishu branch secretary Elijah Maiyo wey dey lead di demonstration say dem want full implementation of di 2021-2025 Collective Bargaining Agreement (CBA).

Source