James Earl Jones, voice of Darth Vader, die at age of 93

James Earl Jones

Getty Images

James Earl Jones, di Hollywood actor and voice of Darth Vader don die at di age of 93 years, im agent tok.

E die early on Monday morning wit im family around am, agent Barry McPherson add.

Jones star inside many feems including Field of Dreams, Coming To America and Conan di Barbarian.

Im dey most popular for giving di Star Wars supervillain Darth Vader im very different strong voice.

Mark Hamill, wey play Vader son Luke Skywalker for Star Wars, post “RIP Dad” wit broken heart emoji as e share news tori of di death.

Jones na also di voice of Mufasa for Disney 1994 film The Lion King, and CNN “This is CNN” tagline.

E win many awards including Emmys, Tony Awards, Grammy and one honorary Oscar.

Jones voice Darth Vader in di original Star Wars feem, wey come out in 1977, and di odas The Empire Strikes Back and Return of the Jedi.

E repeat di role in oda feem dem wey come out such as di first set of di Star Wars anthology series, Rogue One, and di third instalment of di sequel trilogy, Star Wars: The Rise of Skywalker – wey come out in later 2010s.

Na different actor dey always wear di Darth Vader costume and provide di movement for di famous bad character, including di late David Prowse, wit Jones adding im deep voice wey pipo dey quick sabi.

“I love to dey part of dat whole myth, of dat whole cult,” Jones bin tok for one interview, adding say im dey happy to do wetin fans want am to recite, “I am your father” line.

Jones say im no make much money from di Darth Vader part – only $9,000 (£6,884) for di first feem – and e consider am ordinary special effects job.

Im bin no even want make dem give am credits of di first two Star Wars movies, according to Reuters news agency.

Wen di feem dem break all box office records, e gatz rethink im decision.

Jones also dey popular as a television performer, wey play di older Alex Hailey in Roots: The Next Generation and win one of im two Emmys for di lead role in di US drama Gabriel’s Fire.

Dem use im strong tones in The Simpsons and e appeared in di early episodes of Sesame Street.

Jones also tackl many iconic Shakespeare characters ontop stage, including Othello and King Lear.

Source