From ‘Assurance to Altar’ – How Davido and Chioma relationship take waka

Even though Nigerian superstar David Adeleke wey pipo sabi as Davido don confam say im and im babe Chioma dey tie di knot officially, di truth be say di couple don marry for almost one year now.

But Davido announcing officially say di wedding go happun in di coming days, and di subsequent release of di ‘Chivido’ pre-wedding pictures don set di internet on fire.

For March 2023, Davido bin reveal for interview wey im bin do in anticipation of im new album, Timeless say e don marry Chioma already.

Dis marriage bin happun during im break from music afta dia first pikin, Ifeanyi pass away for November, 2022.

Dis union don tay wey e don dey come so, as Davido propose give Chioma for London, wen she bin still get di belle for Ifeanyi for September 2019.

But e be like tinz cool off afta di boy turn one.

But for 2022, Davido bin reveal say dem bin don start to dey plan for dia major wedding wey go shake di kontri.

But las-las, dem marry behind close door.

‘Chioma na di only pesin wey I fit trust wit all my children’

From 2018, wen Davido reveal im babe as “Chioma, my lover” for di song Assurance, Davido neva really miss opportunity to gush about im babe.

For interview wey im give in 2023, e tok say, e don know Chioma for 20 years say dem meet wen e dey first year for University.

E call am say she be “part of am” and na di “best decision I don ever make” to marry am.

According to Davido, dem don dey date since around 2013.

Tori no too comot about di both of dem till April 2018, wen Davido break internet wen im buy Porshe dash Chioma for her birthday, e also do major unveiling of am as im babe for di music video of im single, Assurance.

Afta dat reveal, di very next month, Chioma wey her maiden name na Chioma Avril Rowland, comot wit partnership deal for one cooking show.

As at now, her channel for YouTube for The Chef Chi Show don gada ova twenty one thousand subscribers wit 24 videos.

For August 2019, Davido reveal say dem take dia first trip togeda wen dem go Cotonou.

Den for September, 2019, Davido announce say dem don do dia introduction even bifor dem drop di news say dem don engage later in di month.

Dem born Chioma first pikin and Davido third pikin, Ifeanyi for October of dat year.

Di couple continue to dey pepper pipo for di first year of di pikin life, and Chioma launch her own work as brand influencer, plus including di cooking show wey she bin dey run.

She follow feature for more music videos wey Davido do, like for December 2018, wit Wonder Woman and for March 2020 wen she feature for di video of 1 Milli.

Davido use di opportunity wen e dey promote di song to hype im woman say, “Chioma na di only pesin wey I go fit to leave all my pikin wit, wey be say I go get peace of mind.”

But tragedy nack dem for November 2022, wen just less dan one month afta Ifeanyi 3rd birthday, e bin drown for inside swimming pool.

E bin force di musician and im long time babe to no too dey outside like dat and na at dat time wey Davido declare say im no go dey post im private life for outside again.

Na at dat time, Chioma also stop to dey post for her public account even though e still dey public.

For December 2022, di two of dem show for Qatar wia Davido bin dey perform for di 2022 World Cup.

However for October 2023, almost a year afta dem lose dia first pikin togeda, di musician announce di birth of dia twins for America.

Davido profile

Davido

Getty Images

Nigerian musician, Davido don make many music since im start im career for 2010.

Born on 21 November, 1992, di Nigerian-American singer na heavyweight for Nigerian music industry.

Forbes for 2020 label Davido as Afrobeats superstar. Dem say e be one of Africa biggest musicians.

Since im rise to fame, Davido don win multiple awards, including BET awards and MTV awards. E also dey signed on to many endorsement.

For 2008, e make di Forbes Africa 30 Under 30 list.

For 2024, Davido gbab im first Grammy nomination for im Timeless Album. E gbab di nomination for Best African Music Performance, Global Music Album and Global Music Performance.

E don sing wit American stars like Chris Brown, Nicki Minaj among odas.

Chioma profile

Chioma Avril Rowland, wey pipo know and dey call Chef Chi become popular afta she enta relationship wit Davido.

Davido bin introduce Chioma give di world for September 2019.

Although gist about dia relationship bin don dey for di beginning of di year with visit to one family event.

Dat time, for usual Davido fashion, oga cari Porshe give am as gift as she turn 23 years old wey scata di internet.

Na di same day, e give Chioma Porshe na im e drop new music wey im call Assurance wey feature madam for di video.

Di vibes wey bin dey flow for dat period show for di release of di song, wey make di video get ova one million view in one day.

Chioma and Davido enjoy close relationship pass im oda children mothers.

Chioma Instagram bio say she be chef and she also dey into fashion business.

Source