Hospital wia Aduke Gold die tok how gospel singer lose her life

University College Hospital (UCH) Ibadan don react to di death of popular gospel singer Aduke Ajayi aka Aduke Gold wey die on Monday.

Na on Tuesday morning, di tori start to flood social media afta fellow musician, Esther Igbekele post about di mata for her Instagram page.

For her caption she write say, “RIP Aduke Gold. A General don fall.”

Dis dey come four months afta anoda gospel artiste, Morenikeji Egbin Orun.

One video bin trend on social media wia one man bin tok say “finally, UCH release Aduke bodi afta several hours of shouting, screaming, dem finally release am”.

Tok-tok pesin for UCH Funmilayo Adetuyibi tell BBC say na dia hospital Aduke Gold die and also chook mouth on di video wey bin trend on social media.

She say di pipo wey dey di video bin dey para say dem no quick write Aduke Gold death certificate.

Adetuyibi say wia Aduke Gold die no dey in care of di doctor wey family bin dey ask for di singer death certificate.

Di tok-tok pesin say na general ward Aduke Gold dey all through her stay for UCH but na inside wia she go do diagnosis she die.

She say di doctor say na wia she bin go do diagnosis go write di death certificate. Di tok-tok pesin say na wetin cause delay in writing di death certificate, wey make di pipo dey para.

“She bin dey go through diagnosis, na in di process of di diagnosis she die. No be ward or theatre she die. I no fit disclose too deep into her medical record”.

She say dem bin refer Aduke Gold to UCH from Olabisi Onabanjo Teaching Hospital for Ogun State on 3 August.

Adetuyibi add say treatment bin dey go well bifor Aduke Gold death.

@femimotivator

FINAL UCH RELEASED @ADUKE GOLD body #viral #viralvideo #trending #global #adukegold

♬ original sound – femimotivator

Reactions dey come from all ova social media as some pipo dey ask wetin dey happun for di Christian ministry like dis wey pipo dey die.

While odas remember di musician for di ogbonge Youba spirituals wey she dey drop like, Nitori Ogo.

Who be Aduke Gold?

Dem born Aduke Ajayi, wey many pipo sabi as Aduke Gold, for 1990 for Ilesha, Osun State.

Aduke Ajayi bin lose both her parents wen she dey four years old.

Wen she first start her music career, pipo bin dey call her Aduke Penkele sake of how slim she dey and look for stage.

Di late Aduke Gold bin get opportunity of free education to go university wen one commissioner for youth affairs and sports for Lagos State at dat time, Opeyemi Bamidele, bin give free education.

And she graduate for Lagos State University wit degree for International Relations.

Late Aduke Gold also study about children, and gbab Diploma award for United Kingdom.

Aduke Gold also learn about pipo wit special needs, di care and breeding of fish, teaching and cake making, apart from di music wey make her popular.

On Monday night, August 12, 2024, Aduke Ajayi bin leave di world.

Source