Alexx Ekubo Wedding: Nollywood actor Alex Ekubo and Fancy Acholonu marriage date

Alex Ekubo and Fancy Acholonu don announce dia wedding date.

Di Nollywood actor announce on Monday say both di traditional and white wedding go hold for November of dis year.

Di wedding wey dem nickname, Falexx Forever, go hold for Imo state.

Alex Ekubo traditional marriage go hold on November 20, 2021.

And di Church wedding between di actor and im fiancee Fancy Acholonu go happun on November 27, 2021.

Oga Ekubo bin wet pipo throat on Saturday wen im tell dem to wait till di new week to announce di date.

True to im promise im don tok wen im go wed im businesswoman, fiancée, Fancy Acholonu.

E bin shock plenti of im fans last week wen im announce say im dey engaged as many pipo bin no even sabi say e get babe.