Chidimma Adetshina go participate for Miss Universe Nigeria afta controversy with Miss South Africa

Chidimma Adetshina don confam say she go participate for Miss Universe Nigeria afta controversy for Miss South Africa wey see her drop out of di competition.

Dis na after an initation from di organisers of di competition.

For one video ontop im X account, Senator Ben Murray-Bruce wey be one of di owners of di Silverbird Group wey dey organise di pageant saye, “we welcome Miss Chidinma Adetshina to participate in di Miss Universe Nigeria 2024 beauty pageant.

Chidimma for di video thank everybody wey don support her and confam say she accept di invitation to participate for di pageant.

“I don receive invitation from The Silverbird Group who be di organisers of di Miss Universe Nigeria beauty pageant, and I say dis with great excitement because I don decide to participate for di Miss Universe Nigeria 2024 Beauty Pageant.” She tok for di video.

Ms Adetshina enter limelight after her citizenship bin cause controversy on social media afta some pipo bin call on di organisers of di pageant say make dem disqualify her as dem allege say she no be South African.

Di beauty model get Nigerian father and her mama get Mozambican roots but dem born Chidimma for South Africa.

Di mata take a new turn afta South Africa Home Affairs bin announce dia preliminary findings say indications show say Ms Adetshina mama commit fraud to register her at birth.

According to di Department of Home Affairs, on Monday 5 August 2024, di organisers of di event bin send di department one request to verify di citizenship of one contestant, Chidimma Adetshina.

Dem say dis request dey accompanied by written consent from both Adetshina and her mama.

Department of Home Affairs, for dia preliminary findings allege say:

“Prima facie reasons exist to believe say fraud and identity theft fit don deycommitted by di pesin recorded in Home Affairs records as Chidimma Adetshina’s mama;

“Adetshina no participate for di alleged unlawful actions of her mama, as she be pikin at di time wen di activities take place for 2001;

“One innocent South African mama, wey her identity fit don dey stolen as part of di alleged fraud committed by Adetshina mama, suffer as a result becos she no fit register her pikin;

“Di Department don broaden dia investigation to identify and pursue any officials wey dey involved for di alleged fraudulent scheme, and dey obtaining legal advice on di implications of di alleged fraudulent activity on Adetshina citizenship status; and

“Upon di completion of di investigation, Home Affairs intend to press criminal charges against all implicated parties.”

Di Department of Home Affairs tok say e get some ongoing tok-tok wit all stakeholders wey include Adetshina mama.

Dem say, “Dis case wey come from alleged mago-mago activities wey dey committed 23 years ago, bin give reason make di Home Affairs begin dey use digital way for applications and verification processes so e go help di department against mago-mago wey be like di reform wey dem do for di South African Revenue Service for di late 2000s.”

“Di case also tok on di reason for di department to block certain duplicate IDs, and say di court order of unblocking of dis documents gatz dey handled wit caution.”

Department of Home Affairs say throughout dis process, dem dey guided by commitment to restore and uphold di rule of di law as well as di rights of all parties.

Chidimma mama and family neva comment on di findings by di Department of Home Affairs.

Source