Who attend Tinubu first Council of State meeting?

Nigeria President Bola Tinubu dey chair di first Council of State meeting since e take office as President of Nigeria.

Di meeting dey go on currently for inside di Aso Rock presidential Villa for Abuja, and according to State House tori pipo, former Presidos Goodluck Jonathan and Muhammadu Buhari don already dey for di meeting.

Two former military Heads of State – Yakubu Gowon and Abdusalami Abubakar – dey join di meeting virtually. However, former Presido Olusegun Obasanjo no dey for di meeting and e no join virtually according to tori.

Also di Senate Presido, Godswill Akpabio; di Secretary to di Goment of di Federation, George Akume; and di National Security Adviser, Nuhu Ribadu, dey follow take part for di ogbonge meeting.

Many State govnors also dey take part either physically or some of dem join virtually, including some bifor bifor Chief Justices of Nigeria.

E neva dey clear wetin be di main agenda for di meeting, but e dey come just three days after di ogbonge protest wey bin rock Nigeria from August 1 to 10, wia pipo troop out for di streets to show dia vex sake of hunger and economic hardship for di kontri.

BBC Pidgin go dey bring you updates of dis meeting as e dey happen.

Wetin be di Council of State?

Bola Tinubu

Reuters
Presido Tinubu na also di Chairmo of di Council of State, according by di constitution

Di Council of State na ogbonge advisory body to di President of di Federal Republic of Nigeria. Di pipo wey suppose dey part of di council and di duties of di council dey contained for di third schedule, part one, section five of di Nigeria constitution.

Na di President be di Chairman of di Council of State and di Vice-President na di Deputy Chairman.

Oda members include: “All bifor bifor presidents of di federation and all former Heads of Government of di Federation; all bifor bifor Chief Justices of Nigeria; di President of di Senate; di Speaker of di House of Representatives; all di Governors of di states of di Federation; and di Attorney-General of the Federation”.

Dia work na to advice di Presido on top some serious matter for di kontri wey di constitution list out, but also di Council of State get di responsibility to “advise di President whenever e request dem to do so on di maintenance of public order within di Federation or any part thereof”.

Wen be di last time dis meeting hold?

Muhammadu Buhari bin hold di Council of State meeting several times during im eight years for office as Nigeria Presido from 2015 to 2023.

For instance for February 2018, di Council bin meet to decide on di appointment of National Commissioners for di Independent National Electoral Commission (INEC). Dis na one of di things wey di constitution list out as di duties of di Council of State.

Also for April 2022, wen issues of insecurity bin dey high for Nigeria, Buhari bin call for a Council of State meeting to chook mouth for di matter.

Dat time, na wen crises happen for Plateau and Benue State wia 106 pipo bin die for Plateau State, and 23 die for Benue. E no tey afta dat, terrorists attack di train wey dey go from Abuja to Kaduna and kill at least eight pipo.

Di last Council of State meeting wey happen for Nigeria na for February 9, 2023, just few days bifor di general election wey bring Tinubu to power.

Buhari bin call dat meeting sake of di wahala wey bin dey happen for di kontri as di election dey come closer, inculding di scarcity of naira, serious fuel scarcity and oda tins.

Why Tinubu call di Council of State?

BBC reporter for di State House tok say dem no give tori pipo di exact agenda for di meeting, but dem dey suspect say e fit be bicos of the situation for di kontri now.

Some of di issues na rising food prices, di fear of food insecurity sake of terrorists activities for northern Nigeria, and di nationwide protest wey just end on August 10.

Source