How prices of food items increase afta 10 days protest for Nigeria

Price of staple foods don soar high for Nigeria

BBC
Price of staple foods don soar high for Nigeria

Di prices of some food items bin increase and e affect buyers wen di EndBadGovernanceinNigeria protest don finish.

Nigerians bin enta street to protest sake of high cost of living for di kontri and wetin dem describe as bad governance.

E be like say di main gist now, apart from di protest, na di high cost of tins wey even cause di protest in di first place.

For Kano, as tins dey settle down afta di wahala wey follow di protest, family pipo and small traders dey struggle wit di way food prices don go up.

Dis dey come as goment bin relax di curfew and open market again afta dem lock am for some days sake of di protest wey turn violent.

Small traders wey get shops for di neighbourhood still dey complain about di high prices.

Musa Ibrahim, wey get shop for Kan Karofi for Kano area, tok say, “Bifor dem close market, our stock don finish, so we go restock, but wen we reach market, we see say di price of noodles don increase from 16,000 naira to almost 18,000 naira. Notin we fit do.”

“We dey sell one mudu of flour for 3,200 naira bifor, but now e don reach 4,000 naira. Bifor, pesin fit buy one full mudu, but now na only one-third e fit buy.”

Plenty family men dey tok say food price don go up well well compare to how e be bifor di protest.

One family man for Kano tok say food items price don increase afta dem open di market.

“Bifor di protest, we dey buy semovita for 13,000 naira, but now e don jump go 17,500 naira,” e tok.

Dis man, wey get six pikin and two wives, tell BBC say e don tire to dey buy food for bulk, now na only wetin dem fit cook for di day e go buy sake of high price.

“Flour too don cost, we no fit buy in bulk again, so we don decide say make we dey buy small small and cook wetin we fit buy for di day,” e add.

Bread sellers for Kano don even tell dia members make dem stop work if dem run out of flour.

Alhaji Jibril Abubakar Hamza, wey be di head of dia association, tok say, “Bifor di protest, we bin dey buy one bag of flour for 63,000 to 65,000 naira, but now e don reach 85,000 naira.”

“Na why we dey tell all our members for Kano make dem stop work once dem run out of di flour wey cheap. We no go allow anybody to make life hard for di common pipo wey dey chop bread.”

For southwest, di prices of some food items bin increase and e affect buyers wen di protest bin start.

Some buyers say markets no open and e affect how dem go take buy food stuffs. Dis make dem dey buy for small shops wey dia prices dey high.

For pepper, some of di buyers wey suppose go di popular Mile 12 market for Lagos State go buy for large quantities no fit comot for house sake of fear.

One market woman wey be Madam Roseline Ahmed for Lagos say her market no move since she no go fit buy more goods for her customers and many of dem no even come out.

“Di garri wey I suppose buy for dat week, I no fit comot go buy am becos di whole area just dry and di market no open. Di pipo wey even get di garri for house in large quantities wan sell am at higher price,” Madam Roseline tok.

One fish seller also add say price of Titus fish bin increase go 7,000 naira per kilo from 6,500 naira wey e be bifor.

“Wetin we dey buy for market no be wetin we meet again, e don change and na wetin dey happun for di kontri dey cause am. Make goment no just leave us like dis,” she tok.

Wetin cause prices of food items to go up?

Alhaji Sabiu Bako, wey be di head of di traders associations for Kano, explain wetin dey happun and di cause.

“Wetin happun be say during di curfew, wen pipo dey house, some pipo go bring out goods and give to oda small traders and tell dem to add dia own profit, wey make dem sell at high prices to make profit,” e explain.

“But we don tok to dem, and dem dey try make di prices come down soon.”

“We dey beg di public for wetin happun. No be our intention; plenty traders get pity for heart, but na situation wey don happun be dis,” e add.

Tori still dey say di traders associations don set up committee to dey monitor how dem dey do business for market to make sure say goods go sell at fair price for di correct wholesalers wey no go add too much profit on top.

Di Cost of Healthy Diet (CoHD) per day for Nigeria don jump to 19.2% – NBS

Di latest report wey di Nigerian Bureau of Statistics (NBS) release for di month of June say, di Cost of Healthy Diet (CoHD) per day for Nigeria don jump by 19.2% from wetin e bin dey for di previous month.

Meaning say for di month of May 2024, pesin wey get 1,041 naira fit chop heathy diet, but for June if pesin no hold reach 1,241 naira, e no go fit chop di same kind of food.

CoHD na di cheapest combination of food wey locally dey available, and wey also meet international diet guideline, per day. Dis one no include transportation and preparation.

NBS say CoHD dey increase faster dan general inflation.

Why tomatoes price crash despite say oda food items go up?

Tomatoes price crashes

BBC
Foto of tomato

Months ago BBC News Pidgin report how tomatoes dey expensive across di kontri.

As e be now wey food items prices dey go up, na different tori for tomatoes.

For Kano wey dey for northern part of Nigeria, basket of tomato dey sell at 27,000 to 30,000 naira for Janguza market wey dey for di state.

Abdulrahman Umar wey dey sell tamatoes for Janguza market for Kano tok say price don come down sake of say di supply dey plenti for di kontri.

“As of now we dey sell basket of tomatoes at 27,000 – 30,000 naira instead of 150,000 naira we bin sell months ago.”

“And we dey expect say di price go crash again to 10,000 naira per basket in coming months,” im tok.

Price of tomatoes crashes in Nigeria

BBC
Abdulrahman Umar wey dey sell tomatoes for Janguza market, Kano, north-west Nigeria

Also for Port Harcourt wey be di oil rich city of Rivers State for southern Nigeria, di price of tomatoes don dey reduce since di end of di EndBadGovernanceinNigeria protests.

Maureen Okoro wey dey sell tomatoes tell BBC Pidgin say bifor di protests, di price bin increase well well as di big basket of tomato bin dey go for as much as 75,000 naira while di smaller crates bin dey sell for between 35,000 to 40,000 naira.

But now wey di protests don end, di biggest baskets range between 45,000 and 50,000 naira, while di small basket dey go for between 15,000 and 20,000 naira.

“Di reason for di high cost bifor na transportation becos di drivers dey pay duty charge and dem dey settle pipo for road as dem dey carry am dey come down south, plus di high cost of fuel – so dem put all dat cost on di tomatoes.

“You know say during di protest many companies no open so di goods don pile up so now wey di protests don end now, all dose ones wey dem suppose bring out dat time don come out so e don crash di price,” Okoro tok.

“So pesin fit buy 500 naira tomatoes now but I no know weda afta dis week di price fit go up again oh, but for now tomatoes dey cheap, even pepper sef, di price don come down.”

Source