Dawisu: Salihu Tanko Yakasai – What to know about Ganduje special adviser pipo hala say ‘miss’

Less dan 24 hours after Salihu Tanko Yakasai wey be special adviser to Kano govnor on media post say APC goment don fail Nigerians, some pipo on twitter dey post say di father of 3 dey miss for over 14 hours.

Dis no be di first time di govnor aide go use im twitter handle @dawisu to criticise goment, e chop suspension from work four months ago after e criticise president Buhari handling of di EndSars protest.

BBC contact Kano Police Command tok-tok pesin DSP Abdullahi Haruna to know whether dem get report say Salihu dey miss but di officer say nothing like dat for now.

“We neva get any report say e dey miss for now.”

Salihu papa wey be popular second republic politician Tanko Yakasai tell BBC say e just get information say im pikin dey wit DSS at di moment.

“Information just reach me now say e dey wit DSS at di moment and e no go pass issues with wetin e post on Twitter yesterday.”

“For now as a family we just dey wait to see wetin go happun, but I dey sure im oda brothers go make efforts to get in touch wit di authorities.”

“I don warn am to stop those im anti goment postings, even wen e post di first one wey earn am suspension, I tell am say if u wan criticise goment, leave your position and dey by di side, but as far as you dey di goment they will take serious offence.”

Meanwhile Abubakar Sadeeq wey dey handle Kano state social media handles and website also confam on Twitter say Salihu dey with DSS at di moment.

BBC try reach Kano state goment through Commissioner of information Muhammaf Garba but e know pick calls or respond to text message on di mata.

Who is Dawisu?

Salihu Tanko Yakasai popularly known as Dawisu on twitter na Special Adviser on Media to DI Governor of Kano State.

Im be former Director General, Media & Communications at Government House Kano.

He also be di Founding Curator of Global Shapers Community of di World Economic Forum Kano Hub.

Salihu Tanko na journalist by profession, former freelance reporter for CNN, writer for YPolitico & Ynaija online media platform.

Im be Harvard Alumni and grassroot politician wit 2 decades of active participation.

He also participate greatly for community development work.

For October 2020, Kano state goment for Northern Nigeria bin suspend di media adviser after e criticise President Muhammadu Buhari for Twitter regarding di way e handle di #EndSARS protest wey dey happun for Nigeria.

For statement wey Commissioner of Information for Kano Muhammad Garba release e say e dey important for public officials to dey very careful with wetin dem dey post online as e fit cause serious trouble.

Recently, Di media aide bin enta twitter to criticise di ruling All Progressive Congress, APC sake of insecurity palava wey dey happun for di kontri and how goment dey handle am.

Twitter user, Abubakar wey be di Kano State Official Website and Twitter handler confam for one tweet wey im post say true-true @dawisu dey for DSS custody.

DSS arrest Dawisu? See reactions to #FreeDawisu

Nigerians enta social media to react to di alleged reports say di Department of State Security Service, DSS, gbab di Kano State Media aide.