Rivers boat accident: ‘My four children die for my front’

Man wey lose five family members for di boat mishap wey happen along di Andoni-Bonny waterways for Rivers state say e don lose everything for im life.

Pastor Ayayi Promise Festus wey drive di boat na also di owner of di boat wey dey involved in di accident. E lose five family members for di incident- four children and one grandpikin but im and im wife survive di incident along with 12 odas.

Pastor Festus from Ngo Town for Andoni local goment area say di incident happen as dem dey return from Andoni to Bonny wia dem dey stay, after di Christmas and New Year celebrations on Monday 8 January 2024.

Fotos of some of di recovered bodies

Godswill Jumbo
Rescuers done recover nine dead bodies from di boat mishap

“On our way coming back on January 8, I load pipo wey no get money to pay transport with my family. Accidentally, our boat capsize in front of NLNG wia no rescue dey.

About 11 pipo die and out of dat 11 pipo, five na my children. We lost everything and dia is no way for me to survive. Everything for my life loss – phone, money to take survive, my family, my boat and evrything go. Way to start I no know. Make una help me.

For my presence my children die. Pipo wey survive with me cry, cry, cry no way.” E tok as e begin cry.

People for beach wia dem recover di bodies

Godswill Jumbo
Rescue efforts still dey go on to recover victims of di boat mishap

Police for Rivers State confam di incident say dem receive information say a wooden local boat powered by a single 25HP Yamaha engine wey carry passengers from Ukwa community, Ngo Town for Andoni LGA to Bonny Island, sink as dem dey approach Amariaria community for Finina Town, Bonny LGA.

Police tok-tok pesin SP Grace Iringe-Koko for statement say di O/C Marine, SP Ogarachi Chima move to di scene of di accident and discover say 11 passengers dey feared dead and dem don begin investigate.

As at Wednesday 10 January, rescuers don recover nine dead bodies of di passengers wey drown for di boat mishap for Amariaria community even as dem still dey continue with di search.

Meanwhile, Rivers State Governor, Siminialayi Fubara don console with families wey lose dis loved ones for di incident and add say di goment go work to ensure safe traveling along sea routes for di state.

Source