Ooni of Ife wife give birth to son: Prophetess Naomi give birth to boy – See wetin di arrival of di prince mean to di Royal throne of Oduduwa

Ooni of Ife, Ọba Enitan Adeyeye Ogunwusi don announce say, im wife, Prophetess Naomi, Olori Silekunola don born son – prince in to di Royal throne of Oduduwa.

E post ontop im Facebook page on Wednesday morning to confam di tori say im wife don born di Prince to di royal throne.

He also confam say mother and child dey do well.

Some months ago, tori bin dey fly upandan say di Yoruba king and im wife, bin welcome a new baby as pipo bin don dey suggest say im new wife get belle.

But as e be, di King just announce di birth of im son on Wednesday.

Dis new born son go be di heir to di throne of di royal Ife palace.

Wetin e mean to be di Prince to di throne of Oduduwa

To be prince of Oduduwa mean to become one of di most important pesin for Yoruba kingdom.

Di prince of Oduduwa get chance to become a king for Ile-Ife.

To be king of Ile-Ife mean say you fit lay claim to di throne of Oduduwa, who dem consider as di first king and most important king of Yoruba land.

Di new prince na di first son of Oba Adeyeye Ogunwusi , di 51st and current traditional ruler of di Yoruba Kingdom of Ile-Ife. Im fit become di 52nd King of Ile-Ife.