Actors chop warning, Adanma Luke suspended – AGN take action afta Jnr Pope death

Di sudden death ogbonge Nollywood actor Obumneme Odonwodo aka Junior Pope don make di Actors Guild of Nigeria (AGN) announce serious actions for di industry.

Three crew members wey dey involved for di boat accident wey take di life of di Nollywood actor on Wednesday 10 April 2024, still dey miss.

Dem don identify one Mr Friday wey also die for di incident and three deadi bodies still dey miss.

As di matter happun, di president of di actors guild Emeka Rollas no gree as im announce serious actions for di industry sake of di recent sad incident

Di news of di death of Junior Pope first hit di social media for Wednesday night, later tori come say im dey alive. E no too long n aim Oga Rollas confam dis for post e do on im Facebook account on Wednesday, 11 April say Junior Pope no make am alive.

‘Make no actor do movie wit producer Adanma Luke’

Actors guild shapaly suspend all di movies wey be say e involve water areas or any movie wey be say boat riding go dey involve till further notice.

Dis na sake of di water accident wey claim di life of dia colleague make di president announce dis new suspension.

“All films wey involve riverine areas and boat riding dey suspended indefinitely,” di Oga Rollas tok.

Di president also tok say make no actor shoot any movie for any locations nationwide on Thursday 11 April 2024.

As part of actions against di producer of di movie wey Junior pope and odas bin dey go shoot, di actors guild say make no actor do any feem wit di producer Adanma Luke.

“Di feem titled ‘another side of life’ dey suspended indefinitely. No actor dey allowed to work wit Adamma Luke as producer till further notice.”

Adanma Luke na movie producer for di nollywood industry and she dey known for different movies wey she don make online.

According to Oga Rollas, dem still dey find di remaining bodies of oda pipo wey fall inside water.

Moments bifor Junior Pope bin die for water

According to one eyewitness, im say dia boat collide wit anoda one sake of say di boat rider no quickly see di oda boat wey dey come. As di boat collide wit each oda, dione wey carry dem Junior pope bin fall inside di water.

On di day wey di boat accident bin happun, Junior Pope bin make a post for im Instagram account wia im tok about how actors risk dia lives to entertain dia fans.

Junior say im bin dey cross River Niger on Tuesday 9 April wit no life jacket and add say im get three pikin dem and na im go raise dem.

“Na only dem born oh, na only me dem born, I get three children na me go raise dem, I get three children na me go raise dem oh, bros abeg, oh Jesus wetin be dis, bros abeg na abeg…

“Abeg take am small small… See di risk we take, pipo, to entertain you, live and direct on River Niger,” Junior Pope tok.

Unfortunately, im no make am alive as dia boat capsize inside di water.

Pipo mourn Junior Pope

Former senate president of Nigeria Dr Abubakar Bukola Saraki say di nollywood don suffer a huge loss.

“Dis sudden loss repreent a tragedy for di entertainment industry, may di family fin strength for dis difficult time,” Saraki post for im X page.

Di presidential candidate of di Labour Party Peter Obi also send condolence to di family of Junior Pope describing his death as a shocking one.

Obi write for im X page say di death of Junior pope na very painful experience and more devastating becos im young and get promising future.

“I dey shocked by di reports of di death of anoda vibrant Nollywood actor, Pope Obumneme Odonwodo, popularly known as Junior Pope. Our entertainment industry and our dear nation dey mourn di death of dis young talented actor.”

Source