Chadwick Boseman: Michael B Jordan reveal touching things about Black Panther star T’Challa wey die from colon cancer

Michael B Jordan and Chadwick Boseman

Getty Images
Michael B. Jordan and Chadwick Boseman attend di 2018 State Farm All-Star Saturday Night for Staples Center on February 17, 2018

American actor, Michael B Jordan don pay powerful tribute to im fellow actor for Black Panther, Chadwick Boseman wey die of Colon Cancer on Friday 28th August.

Michael B Jordan wey act as di enemy, Erik Killmonger for Black Panther write plenty times for im tribute say e ‘wish’ im and Chadwick Boseman get ‘more time’ togeda.

“I don dey try to find di words, but nothing dey come close to how I feel. I don dey think about every moment, every conversation, every laugh, every disagreement, every hug…everything.

I wish we get more time.” Jordan tok.

Emotional things wey Michael B Jordan reveal about Chadwick Boseman

Michael B Jordan and Chadwick Boseman

Getty Images
Michael B. Jordan and Chadwick Boseman attend di Marvel Studios’ BLACK PANTHER Global Junket Press Conference on January 30, 2018

Michael B Jordan wey post foto of im and Chadwick for im social media account, continue to reveal emotional things wey im don do with Chadwick before im death.

“One of di last time we tok, you say we dey linked forever, and now di truth of dat mean more to me than ever. Since nearly di beginning of my career, starting with all My Children wen I dey 16 years old you open di way for me.

“You show me how to be better, honour purpose, and create legacy. And weda you don know am or not…I don dey watch, learn and constantly dey motivated by your greatness.”

Di actor add say Chadwick don give everything to di world and e don show di world say dem be legends and heroes.

“Everything you don give to di world … di legends and heroes wey you don show say we be … go live on forever. But di thing wey hurt di most be say I now understand how much of a legend and hero you be.”

“Through it all, you never lose sight of wetin you love most. You care about your family , your friends, your craft, your spirit. You care about di kids, di community, our culture and humanity. You care about me. You be my big brother, but I never fully get di chance to tell you, or to truly give you your flowers while you dey here.”

Michael B Jordan say im dey more aware now than ever say time dey short with pipo ‘we love and admire’.

I go miss your honesty, your generosity, your sense of humour, and incredible gifts. I go miss di gift of sharing space with you in scenes. I dey dedicate di rest of my days to live di way you did. With grace, courage, and no regrets. “Is Dis your king!?” Yes . he . is! Rest In Power Brother.” Jordan conclude.