British singer Adele announce ‘long time’ career break

Singer Adele

Getty Images

British popular singer, Adele announce say she wan take “long time career break” afta her incredible journey as global musician and performer.

Di Grammy awardee, wey dey popular for her R&B songs tell her fans afta her performance for Munich say she go hold dem dear during di period of her break.

“I no go see una for a long time and I go hold una dear to my heart for di whole length of my break and I go fantasize about dis shows,” she tok.

She explain say she go need to “rest” and take some personal time afta she don spend seven year “building new life for myself, and I wan to live am now. I wan live my new life wey I don dey build.”

Di 36 singer wey hail from London become global artist afta her second album “21” wey top charts across di world and win am, her first Grammy award.

Di “Hello” singer wey get ova16 Grammy awards and 25 nominations, tok say she go wrap up her next performance for Las Vegas to end her shows afta two year of performing.

“I don really enjoy performing for nearly three years now, wey be di longest I don ever do and probably di longest I go ever do,” she tok during her last performance and final show for Munich residency on Saturday.

Adele last album “30” in 2021, win Grammy award for “Best Pop Solo Performance” and six nominations for oda categories.

Di album na di biggest-selling album in di US afta just one day wey she drop di album, wit “Easy on me” topping charts for UK and US.

In July, Adele don bin announce say she dey go on “big break” to do oda creative tins for some time becos she no get plan for “new music at all”.

Di musicians don dey perform on weekends since November 2022 and she go conclude am for 23 November, 2024.

We dey update dis tori

Source