Police declare British national wanted, court remand End bad governance protesters

Justice Emeka Nwite of di Federal High Court, Abuja, don remand 10 pipo for Kuje prison, sake of accuse say dem join for di end bad governance protest wey happen between August 1 to August 10, 2024.

Di Nigeria goment arraign di 10 activists for court on Monday bifor Justice Nwite who be one of di two vacation judges wey dey hold hearings as di Federal High Court currently dey on dia annual vacation.

All of di suspects plead not guilty to di six-count charges of treason, felony, destruction of public property and injuring police officers.

Di accused pesins na Michael Adaramoye also known as Michael Lenin, Adeyemi Abayomi, Suleiman Yakubu, Opaoluwa Simeon, and Angel Love Innocent.

Di odas na Buhari Lawal, Mosiu Sadiq, Bashir Bello, Nurudeen Khamis, and Abdulsalam Zubairu.

One of di allegations tok say di accused pesins bin join bodi wit one Andrew Martin Wynne wey be British Citizen “to destabilize Nigeria by calling on di military to take over goment from President Bola Ahmed Tinubu, by shouting ‘Tinubu must go, soja muskeso’, meaning ‘Tinubu must go, it’s military we want’”.

Cross section of di accused as dem dey inside court

BBC
Michael Lenin, oda end bad governance protesters plead not guilty to treason, felony

Afta di accused pesins plead not guilty, di counsel to FG Simon Long ask di court to remand dem for prison custody.

But Marshal Abubakar, lawyer to some of di accused pesins, raise objection and tell di court say di defendants don dey for custody for long, even bifor di Nigeria goment obtain court order on 22 August to detain di suspects for 60 days.

Abubakar, who dey represent di first to fourth defendant, diafore ask di court to grant im clients bail.

Also, lawyer to Angel Love Innocent, one of di accused pesins, inform di court say im client dey pregnant, and e beg di court to grant am bail.

Afta di arguments, Justice Nwite adjourn di matter to 11 September for ruling on di bail application, and e order say di accused pesins go remain for Kuje prison, except di lady wey go dey for Suleja prison until di next adjourned date.

Di Human rights join bodi Amnesty International criticize Nigerian authorities on wetin dem dey call, “sham trial of protesters”.

For statement wey dem release on Monday, dem call di trial “anoda round of goment unrelenting efforts to punish protesters and demonize protest.”

Amnesty International for di statement wey dem release tell Nigerian goment to release di protesters.

“Nigerian goment don dey wrongly place importance on punishing protesters, witout say dem tok pim on di urgent mata of investigating di killings of plenti protesters across Kano, Katsina, Suleja/Tafa, Jigawa and Maiduguri,” Isa Sanusi, wey be di Director of Amnesty International Nigeria, tok.

End bad governance activits dey inside holding cell of di Federal High Court bifor dem carry di accused pesins go Kuje prison

BBC

Source