Wen fuel queues go end for Nigeria?

Motorists queue for Filling station to buy fuel for Lagos, Nigeria

BBC
Vehicle dey for long queues sake of fuel scarcity.

Nigerians still dey experience scarcity of Premium Motor Spirit (PMS) wey pipo sabi as petrol or fuel.

Many Filling stations across di West African kontri no get di product to sell, while di ones wey get dey sell at higher prices.

Di frustrations make Nigerians to ask questions to know wetin dey really cause di scarcity.

Di Nigeria National Petroleum Company Limited say di reason why fuel scarcity dey na becos (NNPC Limited) dey owe big money.

Dis debt na sake of di supply costs of petrol wey dey affect supply sustainability.

For statement wey di NNPC Ltd Chief Corporate Communications Offcer Olufemi Soneye release, on Sunday 1 September, 2024 dem tok say di “NNPC Limited don agree wit recent reports for national newspapers wey concern di company significant debt to petrol suppliers.

Dis issue of say money no dey don put pressure on di company and na threat to di sustainability of fuel supply.”

Even as Nigerians dey face long queues, waste man hours in search for petrol, many Filling stations no get di product.

Some of di filling stations wey get dey sell for high prices but di NNPC Limited say dem dey dedicated to do dia work as di main supplier of di product.

“In line wit di Petroleum Industry Act (PIA), NNPC Limited remain dedicated to dia role as di supplier of last resort, to ensure national energy security.

We dey actively collabo wit relevant goment agencies and oda stakeholders to maintain consistent supply of petroleum products nationwide.”

Independent Petroleum Marketers Association of Nigeria (Ipman) dey hope say fuel queues go soon end.

Our business dey suffer – Ipman

“We no dey happy as NNPC Limited tok say dem dey owe some of dia business partners,” Ipman president Abubakar Migandi Garima Shettima tell BBC Pidgin.

E say to owe no go fit stop NNPC from bringing products to di kontri, “Nigerians dey suffers sake of di present scarcity.”

£We dey hope say di scarcity go end anytime soon becos now we dey collabo wit dem and we dey discuss di way forward so dat di product go dey available evriwia.”

Im tell NNPC to open dia petroleum reserve to reduce di suffering of Nigerians.

Di Ipman President note say dem dey go out of business and anybodi wey close im Filling station no get di product, and e mean say no business for dem.

E say im dey aware say dem dey also see wetin dey go on and di Independent Marketers no dey happy wit di way tins dey go sake of say na only wen di products dey available dem fit make money.

About di price of petrol for Filling stations, oga Abubakar tok say, e get two ways wey dem dey use get di product and na di way dem use get am go determine di price wey dem go sell am.

“One of di ways we dey get di product na through NNPC dat one na direct from dem and e dey cheaper. “

“Di oda wey na through Depot and Petroleum Products Marketers Association of Nigeria (Dappman) na dem be di depot owners and dem dey sell dis products to marketers at a higher cost.”

Im explain say some depot dey sell dis product for almost 1000 naira [$0.63] per litre.

“Depot for Lagos dey sell for 920 naira how much you expect marketer from di north to sell dis product, which price im fit sell am. By di time im add transportation cost and im profit margin? Na why di price of di product dey go up.”

Why police re-invite NLC president Joe Ajaero for investigation

‘Na we dey suffer doctors strike, e dey painful’ – Patients lament

Why some Nigeria soldiers dey show dia anger and frustration through social media?

Time don reach to investigate di importation scam-Falana

Human rights lawyer, Femi Falana SAN don chook mouth inside di fuel scarcity mata wey no dey gree end for sometime.

Im tok for Channels Television interview say sometin no balance for di equation as im allege say Nigeria goment neva tell di masses di truth of wetin dey happun and wetin dem dey do.

Im make reference to di statement wey di Minister of State, Petroleum bin make, wen im tok say dem no go fit sell petrol for 600 naira again, and Nigeria goment sef bin tok say “fuel subsidy don go” and dem no dey pay fuel subsidy again, but dem still dey spend billions of dollars as subsidy.

“Wit di statement from NNPCL, Nigerians don dey ask questions and time don reach to investigate di importation scam.

“I no dey tok about d joke for di National Assembly, but dis time make di media, civil society groups help to expose di mago-mago.”

Oga Falana wey allege say di number of vehicles for road don reduce, explain say “during di days of boom Nigeria goment bin dey pay subsidy for 68 million litres per day. Now wey problems dey, hunger dey and scarcity dey evriwia, new vehicles no dey road, we still dey pay for 68 million litres of fuel”.

E say bifor dis regime, one Comptroller General of Customs challenge di NNPCL during one public hearing for di Senate.

“Im tok say e no dey possible to smuggle di amount of petrol wey dem dey claim outside di kontri sake of say to carry dat kain amount wey NNPCL dey claim you go need about 2,000 tankers, so wetin don change?” Falana ask.

E say time don reach to “expose di big mago-mago wey dey inside di importation of petroleum products for Nigeria”.

“But again new refineries dey come up, di Dangote refinery go start to refine crude oil by September, dem also tell us say di Port Harcourt, Warri and Kaduna refineries go begin work well, dem even tell us say dem need private pipo wey go help manage am.

Dem o suppose to dey tell us about dis developments and still dey tok about price increase of di product.” im conclude.

Source