Lagos lead from behind for latest world safest city ranking

Foto of Lagos road

Getty Images

According to Economist Intelligence Unit Safe Cities Index (SCI) 2023, Lagos rank di lowest as di safest cities among 60 oda kontris of di world for dia latest survey.

Di SCI report na data from 60 oda states wit details of di state security level.

Dem say Lagos performance na base on di security level of di state.

Dem dey carry out dis survey every year.

Despite dis report, Lagos na di commercial hub of Nigeria and about 25 million pipo dey live for inside di state.

Based on di report analysis, Lagos rank below Tokyo for Japan, Singapore Osaka for Japan and Amsterdam for Netherlands, wey rank as di top four cities.

SCI tok say Lagos for Africa and two oda cities for Americas and Asia rank lowest, Caracas for Venezuela and Yangon for Myanmar.

Di SCI rank 60 cities around di world base on digital security, health security, infrastructure, and personal safety. Dem score dis cities between 0 to 100 point

Dis report dey important because of di quality of life for di population of humans wey bin dey live for dis cities. Also, anoda important factor be di level of sucess of mega cities and how pipo fit travel safely for di environment.

How dem rank di 60 cities globally

Asia cities na six of di top ten safest kontri on di list; Tokyo, Singapore, and Osaka dey lead for safety while Johannesburg for South Africa wey dem rank as di 44th safest city na di first Africa kontri inside di list.

Dis na di rankings of di cities according to di safest;

  • Tokyo
  • Singapore
  • Osaka
  • Amsterdam
  • Sydney
  • Toronto
  • Washington D.C.
  • Copenhagen
  • Seoul
  • Melbourne
  • Chicago
  • Stockholm
  • San Francisco
  • London
  • New York
  • Frankfurt
  • Los Angeles
  • Wellington
  • Zurich
  • Hong Kong
  • Dallas
  • Taipei
  • Paris
  • Brussels
  • Madrid
  • Barcelona
  • Abu Dhabi
  • Dubai
  • Milan
  • Rome
  • Beijing
  • Shanghai
  • Santiago
  • Buenos Aires
  • Kuala Lumpur
  • Istanbul
  • Moscow
  • Kuwait City
  • Riyadh
  • Mexico City
  • Rio de Janeiro
  • Sao Paulo
  • Manila
  • Johannesburg
  • Lima
  • Mumbai
  • Bangkok
  • Ho Chi Minh City
  • Baku
  • Quito
  • Bogota
  • New Delhi
  • Jakarta
  • Casablanca
  • Cairo
  • Dhaka
  • Karachi
  • Yangon
  • Caracas
  • Lagos

Source