Olympic marathon runner Rebecca Cheptegei in critical condition afta alleged fuel attack by boyfirend

Ugandan marathon runner Rebecca Cheptegei wey compete for di just concluded 2024 Paris Olympics don suffer burns.

Di burns na for over 75% of her body afta her boyfriend allegedly attack her.

Tori be say di boyfriend of di athlete allegedly pour her fuel during argument wey dem dey get. Na neighbours rescue Cheptegei afta di attack wey happun for di small town of Endebess.

Cheptegei dey critical condition for one hospital now for Kenya.

Di fire also burn Daniel Ndiema Marangach, wey authorities identify as di boyfriend.

Di two of dem dey collect treatment for Moi Referral Hospital for Eldoret, di main town for di region.

“Pipo hear di couple quarrel outside dia house. During di argument pipo see di boyfriend dey pour liquid on di woman bifor burning her,” Oga Kosiom tok.

Local tori pipo say Trans Nzoia county police commander Jeremiah Ole Kosiom dey aware of di matter.

Cheptegei come from a region just across di border fofr Uganda, bin buy land for Trans Nzoia county and build house, wey dey near Kenya many athletic training centres.

One local administrator for di report wey im file say di two bin dey fight over di land. Police say dem don begin torchlight di matter.

Di 33-year-old Cheptegei, wey finish 44th for Paris get house for Kenya wia she dey live and train.

She also win gold for di World Mountain and Trail Running Championships in Chiang Mai, Thailand, in 2022.

In April 2022, dem find anoda female runner, Damaris Mutua strangled inside house wit pillow on top her face for di Rift Valley town of Iten.

E happun came months afta dem find record-breaking long-distance runner Agnes Tirop stabbed to death for di same town.

Men don also become target of attacks.

Last December, some pipo stab Ugandan athlete, Benjamin Kiplagat to death for Eldoret.

Source