Milson last minute goal upset Ghana for 2025 Afcon qualifiers against Angola

Angolan team celebration

Getty Images
Angola coach Pedro Goncalves say im team gat experience dey go take beat di blackstars

One late goal for extra time by Angola substitute Felicio Milson don win di Palancas Negras dia first three points for di 2025 Afcon qualifiers agaisnt Ghana.

Both teams struggle to create clearcut chances di whole game, wit only snapshots hia and dia.

But inside di third minute of extra time, Ghana defender Abdul Mumin fail to clear one cross into di box, na so Milson don pounce to tap inside di next.

Dat goal for di 93rd minute bin win dem di game wia e secure revenge for Angola afta dey lose to a similar late goal for kumasi during di 2023 Afcon qualifiers.

Bifor di game, Angola coach tok say dey gat experience to hurt di Black Stars for dia backyard, na so dem do am, late into di game.

Di substitutes from Pedro Goncalves, na dem combine to secure all three points for dem.

Afta di fulltime whistle, fans for di stadium bin dey boo di players.

Dis na di first time since 6 February, 2000 (vs South Africa) wey Ghana don lose game for di Kumasi sports stadium.

Wit dis result, Sudan bin dey lead group F wit three points afta dey beat Niger. Angola also go dey 3 points.

Ghana and Niger dey bottom of di table afta di first round of matches.

Di Black Stars go travel to play Niger for dia next group game in four days.

Second Half

FULLTIME!

Ghana 0 – 1 Angola

90+8 Felicio Milson don foul Tariq Lamptey as im dey advance, but afta di freekick, referee don blow whistle for end of di game.

90+5″ Dis na sweet revenge as Angola don do wetin Ghana do to dem for di 2023 Afcon qualifier wit Antoine Semenyo im last-minute winner.

GOOOOAAAAAAL! Angola don score. Ghana defenders don make slow, as Abdul Mumin fail to clear di ball, wey Filicio Milson pounce to score. 0-1

90+1″ Angola bin get counter attack but e don break down.

+5 minutes. Dem don add anoda five minutes to di game.

90″ Kudus delay for di ball too long in front of di Angola box wey defenders don tackle am to win di ball.

89″ Angola bin dey try to create sometin as Luvumbo head one cross ova di bar.

87″ Majeed Ashimeru wey also bin enta di game pass to Tariq as im dey overlap for di wings. Di Brighton defender cross di ball into di net bifor Joseph Paintsil try to connect wit di ball, but Angola keeper catch am.

87″ Ghana don make anoda chance. Inaki Williams bin replace Jordan Ayew.

85″ CHANCE! Semenyo enta di box wit di ball bifor im cutback to KUDUS instead say im go shoot. Kudus im side-foot touch don dey deflected for corner.

83″ Kudus try to do too much wit im overhead shot as im dey fall down in front of di Angola box. Di ball don go wide.

82″ Changes for Ghana. Joseph Painstil don replace Fatawu Issahaku.

80″ CHANCE! Fatawu don release one shot for di oda side but goalkeeper save am.

78″ CHANCE! Angola almost score dia, but for one fingertip save by di Ghana keeper. Corner.

77″ Jordan Ayew get slight chance inside di box back im shot dey blocked.

75″ COOLING BREAK!

73″ Dat na di last action of Mabululu, im dey comot

72″ Yellow Card for Alidu Seidu as im foul Mabululu for di center as di ball break to di striker.

70″ Jordan Ayew don vex for one poor cross wey Fatawu don play into di box wey no find any blackstar player.

69″ Freekick to Ghana as Angolan midfielder don foul am. Partey don take di freekick, ball now fall to Semenyo. Ball eventually fiond Fatawu but im run into roadblock.

68″ Poor cross by Alidu Seidu afta im exchange passes wit Jordan Ayew.

67″ Fatawu Issahaku bin foul im marker inside di Angola box afta im try some tricks wey he lose di ball.

66″ Luvumbu now fire one shot wide off di post.

CHAAANCE! At di oda end, Mabululu don strike one shot from outside di box wey Ati Zigi punch ova for corner.

65″ Ghana break for di counter as Fatawu chip one cross inside di box but keeper don save am.

64″ Semenyo play one fine ball thru di legs of one Angola defender but Jordan Ayew no fit to control di ball wia im run out for goalkick.

63″ OFFSIDE! Kudus collect di ball on top of im chest from one Tariq Lamptery cross, but referee don blow whistle for offside.

60″ Angola don make change wia dey take winger Luvumbo enta di game, wia im begin dey hustle for di ball.

57” Mohammed Salisu spin wey he release one shot ova di bar as im find imserf around di Angola area.

56″ CHAAANCE! Antoine Semenyo take one shot from di edge of di box, but Angola keeper punch am for corner. Good save.

53″ Play don restart. Angola dey try find dia attacker Jason Dala for di Ghana area. Di ball dey dance inside di area, bifor Ghana bin clear am.

52″ Defender Mohammed Salisu and Angola captain Fredy don clash in front of di Angola area. Both players dey for ground.

51″ Ghana win anoda corner.

50″ Abdul Mumin misplace di ball as im try to hit long pass to Tariq.

49″ Kudus drive di ball wey im beat im marker bifor trying one shot from way outside di box, but di ball go wide of di post.

48″ Angola try to break on di counter but di ball don run go ova. Goalkick for Ghana.

47″ Corner for Ghana. Kudus don play di ball inside di box but Angola keeper catch am.

46″ Ghana don pass di ball as referee blow whistle to start di second half.

Halftime !

45+5 Abdul Mumin don foul Mabululu. Referee blow whistle for halftime afat Angola take di freekick.

45+4″ Tariq Lamptey try to get onto di end of one long ball ova di top inside di Angola box, but di Brighton man no fit to reach am.

45+3″ Ghana win freekick for dia defense afta Mabululu tackle Abdul Mumin for dia.

45+2″ Ayew challenge one Angola defender in di air for di ball inside di Angola box, but keeper comot come catch am.

45+1″ Dey don add 5 mins to di game.

45″ Di first half bin dey come to an end wit Ghana trying to create sometin but so far dey no dey successful.

43″ Fatawu try to reach one ball into di box wit di Angola keeper di only player for back, but di keeper Neblu don catch di ball under pressure from di Leicester City player.

42″ Di westham forward try to catach di Angola keeper off im line from di tight angle, di ball go ova di bar.

41” Freekick for Ghana, as Angola defender tackle Fatawu for di right side of di area close to di corner flag. Kudus dey stand behind dat ball.

39″ Ghana win freekick for di Angola area but dey no fit create anytin wit dat ball. Bifor Mabululu chase down one ball as Salisu bin dey mark am. Goalkick for Ghana.

38″ Slow build up by Ghana wit Fatawu, lamptey and Partey. Di ball just dey dance for midfield.

37″ Lawrence Ati Zigi don punch di ball from di corner, bifor Angola lose possession to Ghana for midfield.

36″ Tariq Lamptey tackle Jason Dala inside di box for Angola dia first corner.

34″ CHAANCE! Kudus don release one shot from di edge of di box, goalkeeper don catch am for di second attempt.

Elisha Owusu don foul Mabululu for di Angola area for freekick.

33″ Fataw win freekick inside im area afta im try to control one Thomas Partey pass.

32″ Game don restart.

30″ WATER BREAK!

29″ Semenyo try to create chance for Ghana but Angola defenders block im shot, di ball fall to Jordan Ayew but im hesitate wey Angola clear di ball.

28″ Both teams neva get any clear cut chances so far, but dey don settle for dis game.

27″ CHANCE! Angola forward Nteka don hit one shot way ova di ball afta im receive cutback inside di Ghana box.

26″ Alidu Seidu dey get some treatment.

25″ Mata don foul Alidu Seidu as di Ghanaian player don dey drive wit di ball. Referee don tok to Mata wey im tell am say im last warning be dat.

24″ Dala don shoot one ball on target but e dey weak; goalkeeper Ati-Zigi bin catch am.

22″ Ghana pour forward wit Semenyo as Ayew and Kudus bin dey run enta di box, im pass to Jordan but di Leicester city striker im cross neva reach Semenyo wey don dey call for di cross.

21″ Mohammed Salisu bin commit foul for di middle of di park as im dey track back.

20″ Fatawu carry di ball dey try enta di Angola box but dey stop am right at di edge of di D.

Combination of Jason Dala and Fortuna don win freekick for Angola but di throw neva trouble di Gjhan defense.

19″ Angola win freekick as Tariq LAmptey foul Jason Dala insid edi Angola half to prevent a counter.

18″ Game don stop briefly afta somebodi invade di pitch

17″ Jordan Ayew bin stand behind di free-kick. But di execution for dat ball dey poor. Di pass inside di box neva reach im player.

16″ Bastos don tackle Semenyo as di Bournemouth striker dey drive enta di box. Ghana win throw wey Semenyo don win freekick for di far left corner of di Angola box afta anoda foul.

15″ Ghana attack don breakdown as Kudus im cross from di right side of di box neva fiond any white-shirt for di Angola box.

14″ Referee bin tok to Mabululu say make im relax for di game as im come from behind to challenge di Ghana goalkeeper as im dey try throw di ball inside.

13″ Jason Dala bin dey worry di blackstars defenders; im win freekick afta Tariq Lamptey don foul am, but di resulting freekick dey weak, Ati-Zigi don catch am.

11′ OFFSIDE! Anoda offside for Ghana, dis time Kudus na di culprit.

10″ Second corner for di blackstars as Seidu drive di ball for di far corner bifor im pass to Semenyo, but di Bournemouth striker im shot hit im opponent wey e go corner.

9″ Dala from Angola don swing boot for one ball wey di ball go wide into di stands afta Mabululu chest di ball to am in front of di Ghana box. Afta dat, im raise im hand to apologize for di poor effort.

8″ Angola win freekick for midfield afta Issahaku foul im marker two times.

7″ Good spell of possession for di blackstars, wit Partey, Ayew and Kudus inside midfield but Angola bin dey mark dem well well.

From di corner, Semenyo bin hit one weak shot wide off di Angola post wit di side of im boot. Goal kick.

5″ Jordan Ayew break away wit di ball for di counter but im pass to Kudus dey weak. Angola clear am for corner.

4″ Tins no settle yet, as Fredy bin pick up di ball for midfield but Angola no fit keep di ball.

3″ OFFSIDE! Abdul Mumin play long ball ova di top into di Angola area but ref don blow whistle for offside.

2″ Angola now play one long ball for Mabululu, but im no fit reach dat ball, Ghana don clear am.

Ghana try dey string early passes togeda wit Kudus, Ayew, Partey and Fatawu but di final ball dey weak.

Angola don pass di ball wey dey begin dey play for back bifor Jordan Ayew win early freekick for di center of di park.

1″ Referee Uwikunka from Uganda don blow whistle for di game to start. Angola bin wear dia traditional burgundy jersey wia Ghana wear dia all-white jersey.

Di atmosphere alreadi don charge wit plenty fans for di stadium.

Both teams bin comot enta park wey dey don sing national anthems.

Welcome pipo to di live text commentary for dis game between di blackstars of Ghana and di palacas negras of Angola for di Baba Yara sports stadium in Kumasi.

First Half

Ghana Starting XI: Ati Zigi (GK): Alidu Seidu, Tariq Lamptey, Abdul Mumin, Thomas Partey ©, Mohammed Salisu, Mohammed Kudus, Abdul Fatawu Issahaku, Antoine Semenyo, Elisha Owusu, Jordan Ayew

Angola starting XI: Neblu (GK); Kialonda, Bastos, Carmo, Fredy ©, Show, Mata, Fortuna, Nteka, Gelson, Mabululu.

Source