Osimhen Chelsea move plus oda Transfer deadline day deals

Toney, Osimhen and Sancho club future no dey clear

Getty Images

Victor Osimhen na striker in demand for dis transfer deadline day, e feature heavily for today BBC Sport gossip column.

According to Talksport, Saudi Arabian side Al-Ahli dey optimistic to sign Napoli 25-year-old Nigeria frontman, e fit happun e go be a big blow to Chelsea hopes of signing am.

So di big question na if Osimhen go remain for Europe or move to Saudi Arabia

‘Na real problem wen e come to clubs wey dey look Osimhen side’

I feel say di big tin last season – na if im go fit back up wetin im bin do for di title-winning season [2022-23] under Luciano Spalletti? Im no do am.

I feel say dat na real problem wen e come to clubs wey dey look im side dis year.

You get a 130m euros [£110m] buyout clause, wey Napoli owner want get really close to, but im probably no dey worth half of dat. Dat na why im still dey wia im dey and na why clubs no dey come Naples at dis time to try and to convince am as di Saudi clubs.

E dey look like Chelsea hopes of signing Victor Osimhen from Napoli dey fade.

James Horncastle explain Osimhen transfer situation for im latest edition of di Euro Leagues podcast on BBC Sounds why di Saudi clubs dey beta position to seal a deal for di Nigeria striker.

‘We spend anoda £200m and still we no get striker’

Chelsea fans don chook mouth for di club transfer deadline mata, including di Victor Osimhen case.

Dis na wetin dem tok:

Dan: Shey we neva do enough? We spend anoda £200m and still we no get striker…

Eric: Loan Mudryk to Strasbourg as soon as possible and give Tyrique George chance. E get as e be to see Chelsea unstable defence even afta Silva guidance. We need Tomas Araujo and perhaps one striker – Osimhen, to dey precise.

Richard: Really na all about di top striker and Osimhen na di obvious choice, but only if im wages dey sensible. Otherwise, I go like make di club stop to buy and allow di squad to get to know each oda properly. Di whole ‘bomb squad’ situation also dey messy – I wish say dem fit bring back Chilwell back to di side.

Jacob: I feel say we need a quality striker like Ivan Toney or Victor Osimhen and we need a quality defender too.

Nick: Boehly and Eghbali suppose just put dia cheque book away. Di club no need any more players – goals boku for dis team and spending on Osimhen or Toney go bring only small gain, but for a big cost; e no worth di risk of PSR breach. By all means offload di surplus players but no bring more pipo, abeg.

E be like say Ivan Toney don play im last game for Brentford but wia im dey go no dey clear.

Di striker dey strongly linked wit move to Saudi Arabia, di Bees don already reject Al-Ahli £35m bid for am.

Across London, dem don already tell Raheem Sterling say im no get future for Chelsea, e mean say a move bifor di window close dey likely.

Aston Villa and Manchester United don show interest for di 29-year-old.

Jadon Sancho na anoda player wey im leg no strong again for Manchester United.

Di Manchester United attacker, wey bin spend di second half of last season on loan for German side Borussia Dortmund afta im bin fall out wit manager Erik ten Hag, neva play for di Red Devils for Premier League so far dis season.

Paris St-Germain dey linked wit Sancho.

Defender Marc Guehi bin shine well-well for England for Euro 2024 and im form for both kontri and club Crystal Palace dey enta many clubs eye.

Newcastle don bid four times for di 24-year-old, Crystal Palace reject am but e be like say dem go try dia luck once more wit Palace if dem go gree.

Thursday key deals

  • Napoli sign Chelsea striker Romelu Lukaku for £30m deal
  • Liverpool complete di signing of Juventus winger Federico Chiesa for initial fee of £10m
  • Bournemouth sign Chelsea goalkeeper Kepa Arrizabalaga on a season-long loan

Signings fit happun afta di deadline?

Clubs fit still announce deals afta di deadline. Dat na becos dem get a two-hour period afta 11pm West African Time to complete a signing, dat na if dem don submit a deal sheet ahead of di deadline.

Wen di January transfer window dey open?

Di next transfer window go open on Wednesday 1 January 2025 and e go close by 23:00 GMT on Monday 3 February 2025.

Source