Billionaire and founder of Mombasa cement for Kenya Hasmukh Patel don die

Di founder of Mombasa Cement, Hasmukh Patel don die.

Mombasa Cement and Nyuba Group of Companies wey announce di informate on dia X accounts on Thursday, 29 August, tok say di cornerstone of Nyuba Group don pass away.

Oga Patel na philanthropist and na di owner of Mombasa Cement for Kenya plus oda multiple businesses across East Africa kontris.

Di Nation report say tok-tok pesin for di family Samir Bhalo wey confam im death tell dem say Oga Patel wey pipo sabi well-well as Hasu die as e dey receive treatment for one hospital for Mombasa. E add say e die at di age of 58.

Bhaloo tell tori pipo say di philanthropist bin dey sick for two days as e complain of stomach pains.

Di billionaire na ogbonge industrialist and di founder of one of biggest cement industry for Kenya. E also be di director of Corrugated Iron Sheets for Kenya and Tororo Cement for Uganda.

Tributes for Hasmukh Patel

Many pipo wey include politicians dey mourn Oga Patel. Dem describe am as a kind-hearted businessman wey touch di lives of many pipo.

Dem say through im foundation, e support plenty needy gradiuate across di kontri wit scholarships.

Di govnor of Mombasa county, Abdulwsamad Nassir express im sadness on di passing of Hasuu. E say di ogbonge businessman go dey remembered for im active participation for society affairs for Mombasa and im generous support for di underprivileged.

Kilifi county govnor Gideon Mung’aro for im tribute say Patek na respected family wey always dey support and care for im community. E express im condolences to im loved ones.

Source