Tears as dem lay singer Onyeka Onwenu to rest for Lagos

Family of Nigerian singer Onyeka Onwenu don lay di singer to rest on Friday, 30 August for Lagos, southwest Nigeria.

Onyeka wey also be songwriter, actor, journalist, activist, and politician, die at di age of 72.

Her funeral service bin hold for di Fountain of Life Church Ilupeju and burial hold for one private vault for Ikoyi Cemetery.

Wit tears and tributes, dem lay di bodi of late Onyeka to rest for Lagos as families and friends gada to pay last respect to her.

Wen di singer die, President Bola Tinubu bin extend im profound condolences to di family of di late Ms. Onyeka Onwenu.

According to one statement wey Ajuri Ngelale, Tinubu tok-tok pesin, release on Wednesday, di president remember many artistic interventions of di late musical icon in promoting public good.

“President Tinubu celebrate di life of di versatile and extremely gifted artiste wey apply herself to di whole gamut of artistic enterprise and expression, bringing joy and laughter to many.

“Di President condole wit di entertainment industry, di Imo State Government, and di numerous fans of di departed star over dis immeasurable loss,” di statement tok.

Peter Obi and odas dey pay last respect to late Onyeka Onwenu

BBC

How di burial take waka

Early Friday morning, di bodi of late Onwenu arrive for di Fountain of Life Church for Lagos.

We dey update dis tori to bring updates from di burial

Source