Why some Nigeria soldiers dey show dia anger and frustration through social media?

In recent times, more and more Nigeria military personnel don dey show for social media dey para about dia frustrations for battlefield.

Dis na development wey bin no dey hapun bifor bifor, sake of say in di past wen sojas wan complain, dem dey do am in secret and not for public.

Last week, one video bin circulate on social media, wia one man wey claim say im na Nigerian soldier bin accuse di kontri politicians of taking advantage of di security crisis.

But di Nigeria military tell BBC say dem still dey doubt weda dis pesin true true be soja, but dem dey investigate.

Dis no be di first time wey soja dey enta social media para, but dis one complain different from dat of di odas becos, im blame im pipo for failing to end di violence, plus e also no tok at all about welfare or lack of equipment.

Bifore di invasion of Boko Haram for 2009, e dey hard to hear men of di Nigeria army dey complain about welfare or equipment.

But, now, wit di fifteen years war wit Boko Haram wey be like say e no dey end, condition for di military don worse.

As di fight wit di jihadist group still dey kontinu for di north-east of di kontri, some sojas don begin show for social media to complain about wetin dia eye dey see and di goment lack of attention for wetin dey happun on di battlefield.

Dis na despite say authorities for Nigeria don declare many times say di military dey win dia war against di jihadists for north-east, plus bandits wey dey rain terror for north-west wey still dey kill and kidnap pipo almost every day.

For di video, di soja tell Nigerians to “stop blaming men of di Nigerian military, we work wit order.”

E come add say, “assuming our leaders go say make we enta forest and fight dem, honestly, one week we don finish dem.”

Di man tok gel wit di accuse wey some pipo for di kontri dey sama say ‘negligence na part of am’ and dat na why di security problem wey dey worry di kontri hard to end.

One of di tins wey dey disturb Nigerians pass na how dem dey see some pipo wey call demsef bandits dey hold guns, lie and direct for social media, proudly.

Dis one dey make pipo dey suspect say security agents wit clear eye dey refuse to take action against dem, even though dem and di goment dey claim say dem dey do dia best.

For di beginning of dis year, inside one video, one soja wey carry bag for place wey im claim say na Borno state bin dey complain say im no fit pay di transport to travel back home afta im don spend one year fighting Boko Haram.

“As I reach station dem tell me say transport to travel go home na 35,000 naira. As I check am, I see say to go and come back na 70,000 naira be dat. And me, my salary for dis month na 50,000 naira. Dat na why I go just return to di forest jejely becos I no get dat kain choice now,” na so im tok for di video.

Also, remember di video of Brigadier General Olusefun Adeniyi, commander of Operation Lafiya Dole wey dey fight Boko Haram, wia some sojas surround am dey complain about lack of equipment to fight di jihadists.

Dis na officer and commander for di battlefield.

For dis video wey dem publish for March 2020, you go hear di commander dey say: “Sir, as you dey see, our troops don wunjur but we neva stop fighting di terrorists. Dem attack us wit motor wey demo add wit guns, almost 15 of dem.

“Dat na why di calculation wey we do about di situation here no correct… You see how di tire of our car burst sake of bullets, we change many tire, di troop dey try but no tools.”

Small time aft aim do di video, di Nigeria army remove am as commander, carry am go back Abuja.

December dat same year, di military court demote am by three years for breaking di army rule on using social media.

Why junior sojas dey do like dis?

Major Bashir Shuaibu Galma retired believe say, one of di reason why junior sojas dey carry dia complain enta public na sake of say dia leaders no dey kind to dem.

“But again, most of dis complain for social media no mean anytin, unless di complain plenty, im tok.

Also, Brigadier General Sani Kukasheka Usman (retired), wey be former tok tok for Nigeria army, believe say dis na one of di two reasons wey dey make junior doliers do dis ain tin.

“I know say system of complain dey. Wen I bin dey work, di chief of army bin dey sidon wit di troop, from di ones wey get issues plus di ones wey no get any isues, to hear if ay complain dey,” im testify give BBC.

“Dis system den dey call am “durbar”. So I dey free to assume say work too much and di system no dey work properly, or di junior sojas no sabi di laws of di work as dem suppose.”

Major Galma add say evri officer – from colonel to general – politicians get influence to appoint am to position or increase im rank.

“Dat na why conflict dey dey or even gang up between di leadership of di military and politicians, wey dey cause harassment of junior sojas and even make dem give dis kain complain.”

Wetin martial law tok about dis?

General Kukasheka say like oda military forces, Nigeria also get rules for using social media.

“Di condition be say make soldier wey dey duty no post fto wia im wear khaki for social media,” according to di retired general.

Dem sabi military around di world for dia laws and regulations, but Major Galma say e no get any “strict” or “new” law regarding media for di military.

“Di only tin wey di labour law to be say, dem forbid sojas wey dey on duty to release any information, or to deal wit pesin wey dey similar to dis outside di army witout di permission of im oga,” im say.

“Dat na why we get public relations departments for di Air Force, Navy, and Army. No one fit tok witout permission.”

General Kukasheka say di military fit ask for permission to use di internet in different ways but wit di aim of disseminating news.

Source