Sierra Leone former president fly to Nigeria for medical care

Ernest Bai Koroma dey face treason charges for im kontri

Getty Images

Sierra Leone former president dey fly come Nigeria for medical treatment even though im for dey court on to accuse say im get hand for di coup attempt wey happun for di kontri last year.

One High Court for di kontri give Ernest Bai Koroma permission to leave on Wednesday for maximum of three months.

But most pipo believe say dem reach one deal wey allow am go exile.

Im suppose begin face im treason trial for beginning of March.

Bai Koroma bin lead Sierra Leone for 11 years until 2018, wen di current President, Julius Maada Bio, win election.

Pipo sight one Nigeria presidential jet wey carry di former president as e dey Freetown International Airport on Friday afternoon. Di plane take off around 1:30pm (GMT).

All of dis dey happun as pipo continue to guess say, Ecowas, do one deal wit Sierra Leone goment to allow di 70-year-old man relocate, so dat di tension wey don dey di kontri since di attempted coup for November.

For one nationwide address on Thursday night, President Julius Maada Bio say everytin about di mata wey concern im predecessor dey di hand of court.

“Di court don, diafore, im give di former President permit to leave di kontri purely for specialised medical reasons, and dem go suspend im court case during im absence,” im say.

President Bio say im travel no mean say di mata for ground no serious, and dis na more proof say dis mata no be political witch-hunt but instead im purpose na to reveal di truth behind wetin happun on 26 November”.

For di attack wey happun for November, gunmen storm one military barracks and prisons, come free around 2,000 prisoners, di authorities say. At least 21 pipo die for di violence.

Goment say na equivalent to attempt to overthrow am.

Weeks afta wetin happun, dem arrest more dan 80 pipo as suspects – many of dem belonging to Sierra Leone military.

Di former president daughter, Dankay Koroma, name bin dey di list of suspects before. She neva comment.

Di attempted coup bin happun five months afta one elevtion wit plenty gbege, land President Bio for office for second term.

Koroma’s All People’s Congress reject di result.

International observers also criticise di elections, for lack of transparency during counting.

Source