Big Brother Naija Season 5 housemates names: Laycon ‘Chinko Ekun’ crooner of BBNaija 2020 wey real name na Olamilekan Agbeleshe na University of Lagos best graduating students

BBNaija 2020 contestant Laycon wey real name na Olamilekan Agbeleshe na 26-year-old singer and rapper from Lagos.

Laycon na di Best Graduating Student from Department of Philosophy from University of Lagos in 2016

E say im dey complicated, pipo dey misunderstand am and e also dey open minded. E add say im like to dey discuss sexual mata.

E biggest achievement na im song ‘Fierce’ wey dey for MTV BASE Top ten charts for six months.

How Big Brother Naija season 5 go be?

20 new housemates wey enta di Big Brother Naija house on Sunday 19 July no go observe social distancing. Dat na because dem don clear dem of any medical condition including Covid-19.

During di 10 weeks wey dem go stay for di house Big Brother go assign housemates task wey involve team play wey Big Brother know and di housemates need to find out.

Some of di general rules for di house na say di housemates no go get any contact with di outside world, no violence and dem must nominate dia fellow housemate for eviction.

Shower hour no go dey dis season according to di organisers. No be only dat one wey dem cancel for dis season.

No guest go dey allowed inside di BBNaija house or come in contact wit housemates.

Dem also reduce di number of ninja dem too and canel all audience for di live eviction show.

Ebuka go host di Sunday live eviction show for empty studio and den cross live inside di Bigbrother house.