Ighalo leg dey shake for Manchester United, see oda players wey dis table

Ighalo don score four goals for di eight games im don play for Manchester United

Getty Images
Ighalo don score four goals for di eight games im don play for Manchester United

Nigeria striker Odion Ighalo fit return to China when im loan deal expire for May 31, as Manchester United dey struggle to agree extension with Shanghai Shenhua.

Man U sign di 30 year old for short-term loan deal for January as cover for dia striker Marcus Rashford, wey bin dey out sake of back injury.

But, di impact of dis coronavirus wahala mean say Ighalo loan go end before di Premier League return date wey dem dey plan for June, by dat time Rashford suppose don dey fit.

United don already decide say dem no go sign Ighalo permanently, but dem neva give up hope to extend im loan deal.

Manager Ole Gunnar Solskjaer go like make im stay until di season end, onto say dem still get three competitions and fit play up to 18 games im just ova two months.

“As tins be, we neva agree anything. dia league go soon start we just dey wait to see.”na wetin Solskjaer tell MUTV Group Chat

But, negotiation with Shanghai don tie wrapper, di Chinese Super League club still dey insist say im go return as planned.

See oda players wey dey dis table

Mario Gotze (Borussia Dortmund)

Mario Gotze

Getty Images
Mario Gotze don only play five times dis season for Borussia Dortmund

David Silva ( Manchester City)

David Silva

Getty Images
Silva join Manchester City nine years ago from Spanish club Valencia for £21m

David Silva say im go leave Manchester City wen di 2019-20 season end.

Di Spanish international wey be 33 years, don win four Premier League titles, two FA Cup and four League Cup since im join di club for 2010.

E don play 395 times for di club.

Edinson Cavani (Paris Saint-Germain)

Edison Cavani

Getty Images
Cavani joined PSG in 2013 from Napoli

Uruguay striker Edinson Cavani don tell Paris St-Germain say im wan leave di club afta Spanish side Atletico Madrid, “approach” am

Di 32-year-old no too play dis season na oly 14 appearance im make afta Mauro Icardi arrive on season-long loan from Inter Milan dis summer.

Willian (Chelsea)

Chelsea winger contract with Chelsea go soon expire with di London club.

Tori be say di club don offer di Brazilian contract but im no accept di Blues latest contract and im fit leave di club.