Group standings of 2026 World Cup qualifiers for Africa

Mohamed Salah in action for Egypt in World Cup qualifying

Getty Images
Mohammed Salah Egypt dey top Group A

Nigeria drop points again while Egypt maintain dia 100% record for di 2026 Fifa World Cup qualifiers.

Aston Villa midfielder Trezeguet score twice to give Egypt a 2-0 win ova nine-man Sierra Leone.

Meanwhile, Nigeria draw 1-1 away against Zimbabwe afta Leicester City forward Kelechi Iheanacho equalise for di second-half equaliser for di visitors.

Also, Algeria and Gabon extend dia 100% records, while Sudan register a shock win ova DR Congo.

Nine group winners go book di place from di African qualifiers, for di 2026 finals wey go happun for Canada, Mexico and United States.

Di Africa qualifiers go kotinu on Monday, Ivory Coast and Mali dey among di 12 sides wey go play.

Pressure dey grow for boss Jose Peseiro heaf sake of Nigeria two points afta two games, Di Super Eagles dey a point behind Group C leaders South Africa, wey go travel go Rwanda on Tuesday.

Algeria don win two of dia matches for di qualifiers, dem beat Mozambique 2-0 for Maputo, wit second half goals from Fares Chaibi and Ramiz Zerrouki wey silence di hosts, wey bin dey press di visitors before di break.

Di North Africans dey three points clear at di top of Group G.

Gabon also make am two wins from two wit a 2-1 Group F victory away against Burundi for neutral ground for Dar es Salaam.

Jim Allevinah and Denis Bouanga goals help di Panthers win 2-0. Na Gabon dey siddon on top Group F.

Meanwhile, na own goal extend Sudan dia unbeaten start for Group B as dem upset DR Congo 1-0 for Benghazi, Libya.

Di only goal of di game come wit 11 minutes left wen Leopards goalkeeper Lionel Mpasi miscue im clearing punch from corner kick and di ball bounce back off midfielder Charles Pickel come enta inside di net.

Africa World Cup qualifying group table

Africa World Cup qualifiers group B

BBC
Africa World Cup qualifiers group C

BBC
Africa World Cup qualifiers group D

BBC
Africa World Cup qualifiers group E

BBC
Africa World Cup qualifiers group F

BBC
Africa World Cup qualifiers group G

BBC
Africa World Cup qualifiers group H

BBC
Africa World Cup qualifiers group I

BBC

Source