2020 NBA Draft picks: Onyeka Okongwu, Jordan Nwora, Daniel Oturu, Zeke Nnaji, oda Nigerians wey join American Basketball league

2020 NBA Draft picks: Onyeka Okongwu

Getty Images

Nigerians make history for di NBA draft pick wey dem do on Wednesday for di 2020-2021 season.

Dis go also be di first time wey two players wey dem born for Nigeria go dey picked for di first round of di same draft.

Di draft bin suppose hold on di 25th of June but dem move am go fromt because of cornavirus and even now sef na for video calls dem do di draft.

Di NBA dradt na wia teams from di National Basketball Association dey select dia new players from pool of players wey dey eligible and ready to enta di league.

2020 NBA Draft picks:

Getty Images

So make we check dem out

Isaac Okoro – “My mama tell me say make I keep di Nigerian Pride”

2020 NBA Draft picks: Isaac Okoro

Getty Images
  • Im go play for di Cleveland Cavaliers
  • Na Nigerian parents born am for Atlanta, Georgia.
  • E bin dey as di first Nigerian wey dem draft.
  • E bin dey part of di USA winning team for di 2018 Under-17 Basketball World Cup for Argentina.

Onyeka Okongwu – “I wan win championship”

2020 NBA Draft picks: Onyeka Okongwu

Getty Images
  • Na Nigerian parents born Onyeka Okongwu for California.
  • E go play for di Atlanta Hawks
  • Im say im goal na to win championship wey evribodi wan win
  • Im be 19 year old and na shooting guard

Precious Achiuwa – “I fit add plenti agidi and ginger to di table”

2020 NBA Draft picks: Precious Achiuwa

Getty Images
  • Precious Achiuwa na one of di two players wey dem born for Nigeria
  • Dem bin born am for Port- Harcourt before im enta America as teenager
  • Di 21 year old go play got Miami Heat with for odas wey get Nigerian origin

Zeke Nnaji – “I just happy to do everytin I fit do to help my team win”

2020 NBA Draft picks: Zeke Nnaji

Getty Images
  • Di 19 year old go play for Denver Nuggets.
  • Na Nigeerian Papa and American mama born am
  • E bin play college basketball for di Arizona Wildcats

Udoka Azubuike – “Dok na di best defensive player available”

2020 NBA Draft picks: Udoka Azubuike

Getty Images
  • E go play for di Utah Jazz
  • Di 21 year old na di second pesin for di draft dem pay for Nigeria.
  • E start to dey play di game at 13 years old.
  • Dem recruit am from one NBA and Fiba’s developmental camps for Africa

Desmond Bane – “I feel liek I dey bring mature approach”

2020 NBA Draft picks: Desmond Bane

Getty Images
  • Desmond Bane get Nigerian papa and American mama
  • Di 22 year old na di last with Nigerian Origin wey dem put for di first round of draft
  • E start to dey play bareback before im port enta basketball
  • Tori be say im fit dey traded go Memphid Grizzlies.

Daniel Oturu – “Daniel na di most improved player for di kontri”

2020 NBA Draft picks: Daniel Oturu

Getty Images
  • Daniel Otoru na di pikin if Niferian parents wey be pentecostal ministers fir Minnesota
  • Im papa, Francis na former table tennis player for Nigeria.
  • E fit end up for LA Clippers after im move from Minnesota Timberwolves to di New York Knicks
  • Di 21 year old na thrid choice fro di second round.

Jordan Nwora – “I bin no think say I go dey di position wey I dey today”

2020 NBA Draft picks: Jordan Nwora

Getty Images
  • Jordan Nwora bin dey part of di Nigerian basketball team ,D’Tigers.
  • E follow dem play for di 2019 Men’s World Cup
  • John na pikin of Nigerian papa and American mama
  • Im papa, Alexander bin coach di team for di world cup im son participate
  • Jordan na Nigeria highest goalscorer for one match afta im get 26 points for World Cup qualifiers.