Man City secure second trophy on dia way to achieve Treble dream

Manchester City and Manchester United

Getty Images

Ilkay Gundogan score two times including di fastest FA Cup final goal ever, as Manchester City beat Manchester United for trophy two of a possible Treble.

Di City captain volley better shot to di top corner just afta 12 seconds.

United skipper Bruno Fernandes equalize wit a penalty afta di video assistant referee catch Jack Grealish for handball.

Gundogan score anoda volley from outside di box, from anoda Kevin de Bruyne ball, to win am for City.

Pep Guardiola side – wit di Premier League and FA Cup wey dem don win – fit now complete di Treble next Saturday for Istanbul, wen dem face Inter Milan for di Champions League final.

Second Half

Manchester City and Manchester United

Getty Images

Man City 2-1 Man United

90+6mins: FULL TIME

90mins: SUBSTITUTION. Jack Grealish comot for Nathan Ake

84mins: Erling Haaland make solo run, but e fail to create a chance

83mins: SUBSTITUTION. Scott McTominay enta for Victor Lindelof.

81mins: YELLOW CARD. City keeper Stefan Ortega for time wasting

80mins: Bernardo Silva poor effort go wide

79mins: YELLOW CARD! Fred chop card for rough foul

78mins: SUBSTITUTION. Wout Weghorst enta for Jadon Sancho.

75mins: Casemiro decide to strike di ball toward goal, but im effort fail to threaten di goalkeeper

72mins: DISALLOWED GOAL! Ilkay Gundogan score again but linesman catch am offside

69mins: Marcus Rashford play shot from di edge of di box wey go just over di crossbar.

64mins: Wasted effort! John Stones get chance to hit on target but e balloon di ball go up

63mins: SUBSTITUTION. Alejandro Garnacho enta for Christian Eriksen

62mins: Kevin De Bruyne get great chance inside di six-yard box, shoot to di bottom left corner, but David de Gea save am

60mins: Ilkay Gundogan clip a neat ball into di box in di direction of Erling Haaland, but di pass no too make sense.

59mins: United defence dey alert as dem clear a dangerous cross from Kyle Walker

54mins: Aaron Wan-Bissaka produce lovely ball into di penalty area but di defender manage to intercept and comfortably avert danger.

Man City 2-1 Man United

51mins: GOAL! Ilkay Gundogan make am double for City.

50mins: Fred commit ugly tackle on im opponent, but no caution from di referee.

49mins: Kevin De Bruyne send in a pass wey fail to reach any of im teammates.

46mins: Jadon Sancho run towards goal but di defender get recover well to stop am.

Man City 1-1 Man United

45mins: Second Half don start

First Half

Manchester City and Manchester United

BBC

Man City 1-1 Man United

45+6mins: HALF TIME

45+2mins: Ref Paul Tierney blow blow fowl agaisnt Rodri

45mins: 4 minutes of added time.

45mins: OFFSIDE! Ref catch Jadon Sancho for offside.

43mins: Raphael Varane win di ball from di corner kick and strike. Im effort lack accuracy and go wide of di left post.

40mins: Jack Grealish bad challenge make ref blow for foul.

37mins: John Stones deliver fine lofted cross into di penalty area, but dem clear am. Corner kick to Manchester City.

35mins: Kevin De Bruyne beat di defender to di ball in di box and shoot, but di ball go high over di bar.

Man City 1-1 Man United

32mins: GOAL! Bruno Fernandes score from di penalty spot.

31mins: PENALTY to Manchester Utd! VAR decision:

28mins: Kevin De Bruyne find himself wit a great opportunity! E unleash a shot from di edge of di box.

25mins: David de Gea kontinu to pla afta e cal for medical attention

24mins: Marcus Rashford header go wide to di left post afta a lofted pass into di centre of di box.

20mins: Raphael Varane hold his opponent to stop am from getting di ball and di ref blow for foul.

17mins: Erling Haaland runs onto lofted ball into di box, but im leg no hit am well. Easy catch for David de Gea.

16mins: Poor challenge by Fred. Ref caution am for foul.

12mins: Manuel Akanji give away foul afta a hard tackle on im opponent.

11mins: Manchester City dey showcase great team work and neat passing moves.

10mins: Bernardo Silva try to send a pass but dem block am.

9mins: Bruno Fernandes commit foul and Paul Tierney immediately signal for free kick.

6mins: Jack Grealish fires di ball on goal, but im attempt go wide of di left post.

6mins: Kevin De Bruyne whip di ball in, but e fail to reach any of im teammates as di opposition defence avert di threat.

4mins: MISSED CHANCE by Rodri wey for don make am 2 for City

Man City 1-0 Man United

1mins: Goal! Ilkay Gundogan score early goal for City.

1mins: KICK OFF

Manchester City and Manchester United Team news

Manchester City XI: Ortega, Walker, Stones, Dias, Akanji, Rodrigo, De Bruyne, Gundogan, Silva, Grealish, Haaland. Subs: Ederson, Phillips, Ake, Laporte, Alvarez, Mahrez, Foden, Palmer, Lewis.

Manchester United XI: De Gea, Wan-Bissaka, Varane, Lindelof, Shaw, Casemiro, Fred, Eriksen, Fernandes, Sancho, Rashford. Subs: Butland, Dalot, Maguire, Malacia, McTominay, Pellistri, Elanga, Garnacho, Weghorst.

Manchester City and Manchester United head to head

City end di Premier League season wit one point from dia final two matches.

On matchday 38, Brentford beat dem 1-0 to become only di fifth team to complete a league double over Pep Guardiola, afta Chelsea (2016-17), Wolves (2019-20), Manchester United (2019-20) and Spurs (2021-22).

Dat na also City first defeat since February, ending a 25-game unbeaten run.

United dey contest dia 21st FA Cup final, di joint-most of any side in di history of di competition along wit Arsenal.

As well as winning di Carabao Cup, di 12-time FA Cup winners don secure Champions League football next season afta dem finish third in di Premier League, 14 points behind City.

All point to a season of progress for Ten Hag and im players whatever di outcome for Wembley.