Players of Squid Game The Challenge want compensation sake of injuries

Contestants wey bin dey di Netflix shoe Squid Game: The Challenge dey ask for compensation on top how dem allegedly injure for di show, according to dia lawyers.

Express Solicitors dey represent two players wey dem say “suffer injuries like hypthermia and nerve damage.”

Players bin dey compete to win $4.56 on di game show wey bin dey inspired by di ogbonge South Korean drama Squid Game.

Tok-tok pesin for di show tok for statement say, “we take di welfare of our contestants, veri veri seriously.”

Studio Lambert, wey be di company wey co-produce di show for Netflix, don dey contacted for comment.

Express Solicitors claim di contestants wey dem no reveal dia name suffer injuries wen “dem bin stand for hours for inside cold during filming”.

Daniel Slade, CEO of di UK company say, “contestants bin tink say dem dey take part in sometin wey go dey fun and di pipo wey injure no expect say dem go suffer as dem suffer.

“Now dem don get injuries afta dem tanda for painful stress positions inside cold weather.

E add say, “We get case wia pesin complain of hypothermia. One bin get im hands turn purple for di cold.”

Di law firm say dem don send letters of claim give Studio Lambert say dia clients alleged injuries na “sake of poor health and safety standards on set.”

Letter of claim na wetin dem dey send just before legal action. Na to let di pesin or joinbodi know say dem fit enta court on top dia mata.

Di Green Light, Red Light game bin make players run to di end of line as one 13.7ft (4.2m) doll baby bin sing and face di wall.

But wen di doll face di players dem suppose “be like dat”.

Di pipo wey dem catch say dey move dey comot wit video system with plenti referees wey go find di players wey move.

Stephen Lambert, wey be di CEO of Studio Lambert bin tok before say two players wey shapaly cross di line use two hours but di ones wey slow take up to four or five hours.

E tok for press materials about di show say, “everybodi bin hear say e no go easy.”

Last week, one of di contestants wey im name na Lorenzo Nobilio tell BBC News say e take am seven hours to finish di game.

For January, Netflix tok say three pipo collect medical treatment for filming, but “claims say e serious na lie”. Oda contestants bin complain about how di place cold for tori wey Hollywood trade publication, Variety bin do.

Tok-tok pesin for Squid Game: The Challenge say, “No Squid Game contestants don file lawsuit. We carry di mata of welfare of our contestants very seriously.”

Di game bin dey recorded for Cardington Studios wey dey Bedford.

Last week, oga Lambert tell BBC News say dem take players welfare, “terribly seriously”.

E tok say, “everybodi bin dey warm wen di weather bin dey cold. We do all di necessary tins to prepare dem for dat.

“Yes some anonymous pipo bin vex say dem bounce dem, and e be cold, and long experience.

“But e no worse pass many unscripted shows… wen you wan give ogbonge prize, e dey always dey clear to us say e go be tough show to take part in.”

Source