Nigerians fit monitor dia minister now – How?

Federal goment don launch Citizens Delivery Tracker App wey be di kontri first digital app to rate MDAs, ministries and ministers performance and deliverables unda president Bola Tinubu goment.

Hadiza Bala Usman, di special adviser to di president tok say di goment initiative na to ensure say citizens dey part of di governance process in di kontri.

Central Delivery Coordination Unit launch di app on dia website; app.cdcu.gov.ng on April 8 ontop CDCU website, citizens fit download am for dia devices.

She tok say di app go soon dey available for pipo to download.

According to Bala Usman di app go rate deliverables and key performance indicators (KPIs) of ministries in line wit di presidential priority areas.

She explain say di Citizens Delivery Tracker na application wey go allow citizens to see di major programs and projects wey federal goment get for dia area through dia devices.

Usman tok say di tracker do give Nigerians di opportunity to give real-time feedback on dia ministries performance on policies, projects, and programs of government from dia devices.

She explain say di application go maintain di relationship between good governance and di pipo.

Di special adviser to di president tok say dem go collect data from NBS and work wit MDA to review dia performance and ensure say di information dey correct while she encourage Nigerians make dem tell goment di errors wen dem see am.

How di app dey work and how e fit dey effective?

Na opportunity for di president and Nigerians to see di performance and deliverables of ministers projects from dia devices.

Na anoda opportunity for Nigerians to engage wit ministers and di president to see di needed recommendations on each sectors and projects for dia areas such as Infrastructure, transportation, education, health, and social investment.

Also, Nigerians go fit know wen dem go finish project for dia area and di agenda of di projects

Wen you visit di website or download di Citizens Delivery Tracker App; you go see eight presidential priorities for di year 2023 to 2024.

You go click on dis to see di ministry performance; you go see di ministry and minister wey dem in charge of di project and dia deliverables.

Afta, you so see di year duration, di plan and wetin dem go already achieve for di website

Key components of CDT app

Performance Monitoring: Di app dey provide platform for citizens to observe and evaluate di performance of public office holders, ministers, base on dia achievements and contributions towards President Bola Tinubu 8-point agenda and oda objectives.

Ministerial Assessment: e allow citizens to dey monitor ministers and dia deliverables, and enable transparency for goment office.

Feedback Mechanism: Citizens dey encourage to voice dia concern about some issues for dia area and make major shift wey go include everibodi for goment.

Access to Information: Di go feed citizens information on ministers deliverables, recognising citizens and dia role in governance process.

Real-Time Feedback: Nigerians fit provide immediate feedback on dia view on di goment performance in policies, projects, and programs anywia for di kontri.

Transparency and Accountability: Information on goment priority projects and programs across di nation dey available for transparency and accountability.

Direct Communication: Di app go facilitates direct engagement between citizens, president and ministers ensure say dia voices dey effective.

Source