BBNaija 2020 eviction: Ka3na na di first pesin to leave big brother season five lockdown house

Ka3na don become di first pesin to leave big brother Naija season 5 lockdown house afta like two weeks wey im enta di crib.

Lilo, Eric, Praise and Ka3na na di four pesin wey fans bin put up for eviction for di big brother Naija season 5 lockdown house.

Out of di 20 housemates, 18 na im bin dey up for eviction dis week except di head of house Lucy and di pesin wey she select as assistant head of house- dat na Prince.

According to di new method of eviction from Biggie house, each housemate go later come enta di Diary room to nominate one pesin among di four housemates wey fans put up for eviction.

Dis na di first time di organizers of Big Brother show dey introduce dis method for di history of di show.

See how di nomination waka

Brighto nominate Eric and Kat3na

Nengi nominate Kat3na and Praise

Ozo dey so emotional and reluctant to nominate

We still dey update dis tori as e dey happun