Hillside Endarasha academy fire leave almost 20 school children dead

Seventeen pupils don die afta one dormitory for one boarding school for central Kenya catch fire on Thursday night, di Ministry of Education confam.

Fear dey say di death toll fit rise as dem don carry more dan a dozen odas wey get serious burn go hospital.

More dan 150 pupils bin dey di dormitory wen di fire start around midnight local time. Di school dey care for children wey dey between age five and 12.

Di cause of di fire for Hillside Endarasha Academy, for Nyeri county, neva dey known.

President William Ruto don call di fire “horrific” and “devastating”, and don order make dem do investigation.

“We go hold those wey dey responsible to account,” Oga Ruto bin write on social media.

Police toj say dem don send one team of investigators, including forensics experts go di school.

Di Kenya Red Cross say dem dey provide psychosocial support services to di school children, teachers and families wey dey affected and don set up a tracing desk for di school.

Di agency say dem dey collabo wit di multi agency response team wey goment arrange to link parents wit dia pikin, even di ones wey dey hospital.

70 children still dey miss – Kenya Deputy President

Kenya Deputy President Rigathi Gachagua tell tori pipo say 70 children still dey missing following di fire incident.

E call on parents wey don pick dia children from di hostel plus neighbours wey help those wey run to report to authorities.

Goment go assist families wit burials and help wit hospital bills, e add.

Oga Gachagua also say dem go make report into di cause of di fire public once e complete.

John Githogo, di uncle of one missing schoolboy, tell tori pipo for Nyeri say to wait for news na “torture”.

“Dem tell us sau some of dem don die, some run away, parents pick some of dem.

“But we no pick our boy. We no know if e run away,” Oga Githogo tok.

“We no know if e dey among di pipo wey don die, or among di pipo wey run away. Na torture.”

Francis Wachira, wey get daughter for di school, tell AFP news agency say na “very little information” dem get.

“Dem tell us say some children escape but dem no tell us wia dem run go,” e tok.

Kenyan Ministry of Education say di school get 824 pupils – 402 boys and 422 girls. Of di total, 316 na boarders.

Di Nyeri county govnor, Mutahu Kahiga tok say di fire na “great loss” wey don “carry young pipo wit promising future waka go”.

Firefighters bin put out di fire wit di help of pipo wey dey live nearby, dem be di first to respond.

Local official Samson Mwangi Mwema tell BBC say di rescue operation dey difficult, e say: “We see say di dormitory don catch fire, we bin try to rescue – we see some children under di bed and we rescue dem.”

Di International Committee of di Red Cross (ICRC) tell BBC say dem dey operate one temporary trauma centre for di school and dey counsel 59 children.

Tori pesin from network Citizen TV, di fire bin spread fast-fast sake of say most of di buildings for di school na timber dem take build am.

Hillside Endaraha Academy na private primary school wey get ova 800 students wey dey between di age of five and 12 years old. Di school dey near Nyeri town wey dey 150km north of di kontri capital, Nairobi.

School fires dey common for Kenyan boarding schools.

In 2017, 10 students die for one arson attack for Moi Girls High School for di capital Nairobi.

School fires are relatively common in Kenyan boarding schools.

At least 67 student die for Machakos County, south-east of Nairobi, in di deadliest Kenyan school burning wey happun more dan 20 years ago.

Source