Who fit replace Ajuri Ngelale as Tinubu spokesman?

Nigerian presidency don accept Ajuri Ngelale request to proceed on indefinite leave of absence as spokesman aka tok-tok pesin for di administration.

Now wey di presidency don accept Oga Ngelale request di koko na who go replace am.

According to di statement wey Oga Ngelale write e say di reason for im decision na becos of personal and health related mata.

Although im no give much details on di health challenge but im add say make pipo respect im family privacy dis period.

Di president office thank am for im ‘’ tireless effort and dedication for serving di nation, and praise am for di ogbonge contribution im make for different capacities, especially on national issues and leading efforts on climate action and oda key initiatives.’’

President Tinubu appoint Oga Ngelale as im official spokesman as well as im special adviser on media and publicity for 31 July, 2023.

During President Muhammadu Buhari regime two pipo occupy di role of spokesman, Femi Adesina and Garba Shehu.

Oga Adesina bin act as di special adviser to di president on media and publicity while Oga Shehu act as di senior special assistant to di president on Media and publicity.

Both Oga Adesina and Oga Shehu serve di president until im tenure end for 2023.

Check out some of di names wey many pipo dey tip as Tinubu next spokesman.

Bayo Onunuga

Bayo Onunuga na di current special adviser information and strategy to president Tinubu.

During di election im act as director for media and publicity for di Tinubu / Shettima campaign.

Oga Onunuga na experienced journalist, na him co-form TheNews Magazine and also im be former CEO and Editor-in-Chief of PM News.

Di 67 year old also don previously serve as Managing Director of di News Agency of Nigeria.

Oga Onunuga na strong ally and vocal supporter to di Nigerian leader policies.

Some of im views on national issues don make di news, di most recent na about di protest for August.

For July 2024, Onanuga bin put for im X page say di candidate of di Labour Party (LP), Peter Obi dey behind di nationwide protest wey happun for August 2024.

Dat tok vex some youth activist wey demand say make di presidency comot am for di position as one of di president tok tok pesin. Even Obi bin almost threaten to sue am.

Im outspoken nature fit be a concern for di presidency to pick am for dat role

Sunday Dare

Sunday Dare na former minister for youths and sports under president Muhammadu Buhari regime.

Before im collect appointment as minister im serve as executive commissioner in charge of stakeholders management, Nigeria Communications Commission (NCC).

Na journalist wey don work for diverse aspects of di media, wey includes: broadcasting (TV and radio), journalism (electronic and print), wit ova 25 years experience.

Oga Dare don work as SA on media to president Tinubu bifor wen e be govnor of Lagos state bifor.

Many pipo say Oga Dare as safe choice to be president Tinubu spokesman becos of im calm nature.

Although Oga Dare bin chook mouth inside di #Endsars palava wey happun for 2020. E bin order for investigation into reports of “increasing attacks and harassment” by SARS division of Nigerian Police.

Oga Dare from Ogbomosho for Oyo state, south west Nigeria.

Daniel Bwala

Daniel Bwala na lawyer and former tok-tok pesin of people’s democratic party presidential candidate Atiku Abubakar.

Early dis year im shock many pipo wen im decide to dump di PDP candidate Atiku to work wit president Tinubu.

President Tinubu, bin invite Oga Bwala am as guest to di villa for Abuja wia im call on Nigerians to support di goment.

Although Bwala bin support President Tinubu during di presidential primaries of di APC, but withdraw im support becos of di controversial Muslim/Muslim ticket of APC.

Some pipo feel say Oga Bwala wey be northern Christian get di capacity to hold dat position.

Source