Niger vs Ghana 2025 Afcon qualifier match preview

Di Blackstars of Ghana and di Ménas of Niger go clash for dia 2025 Afcon qualifier dis afternoon.

Both teams bin lose dia opening games for group F.

Sudan wey don dey lead di table defeat Niger 1-0, wia Angola sama Ghana 0-1 for Kumasi.

Di Blackstars lose dia first game for Kumasi in 24 years last week, afta Felicio Milson 93rd minute goal win Angola all di 3 points.

Afta di game on Thursday, Angola coach Pedro Goncalves tok say im team play well well vs one of di ogbonge teams for Africa.

But im tok say di pitch wia dem play di game neva good.

“Kontri like Ghana deserve beta pitch and stadium for dia players.”

Ghana coach Otto Addo also bin agree wit di Angola coach.

In fact, im defend one player Abdul Mumin wey no clear one ball inside di box wey allow Angola to score di winning goal.

Otto Addo tok say di ball “don bounce awkwardly in front of di defender and dat na why im no fit to clear am well.”

Coach Otto Addo and im boys now get to ensure say dem go beat Niger for dis game wey dem go play for Morocco.

Both teams bin train for Morocco since dem arrive on Saturday.

File photo of the Niger football team

Getty Images
Di last time di Mena of Niger play for Afcon na 2013; dem hope say dem fit qualify for 2025

Niger v Ghana team news

Ghana arrive in Morocco wit only 22 players.

Turkey-based defender Jerome Opoku don hurt wey im no fit to travel wit di squad.

One statement from di Ghana football association tok say “di player don report to di medical team say im get pain inside im left gluteal muscle”.

“Further examination don show say di pain don increase sake of di poor pitch wia im train on for Kumasi,” di GFA add.

Jerome don return to im club for Turkey.

Anoda player wey neva travel to Morocco wit di team na La Galaxy player Joseph Paintsil sake of passport wahala.

“Paintsil don pull out sake of dis passport mata. Im dey Accra to sort out di passport wahala bifor im go return to di US to join im club,” di GFA tok.

Di Mena of Niger also bin train two times ahead of di game.

“Di Niger team don inspect di RS Berkane lawn wia our match wit Ghana go happun, wey we train well,” di Nigerien Football Federation tok.

Dem go hope say captain Youssouf Oumarou go lead di team to victory against di Blackstars.

“E dey important say we go bounce back from our first defeat against South Sudan. Di kontri and our fans dey support us. We go give our best for dis game.”

Niger coach Badou Zaki afta di CAF Afcon draw in July dis year tok say im get confidence for dat match.

“We dey get evri chance to qualify for dis group. Ghana na football kontri wit ogbonge players but e neva be di team from 5 or 6 years ago. Even at home, dem fit to lose,” di coach tok.

Niger go stick wit di team wey lose narrowly 0-1 to Sudan.

Dem fit maintain dia defense wit Abdel Rahim Alhassane, Abdoulaye Katore and Philippe Boueye.

Striker Daniel Sosah wey score 4 goals for 19 games go lead di attack, wit support from captain Youssouf Oumarou and Yusif Moussa.

For team Ghana, midfielder Majeed Ashimeru fit to start alongside captain Thomas Partey.

Sabi pipo bin tok say coach Otto Addo gatz start Athletic Bilbao striker Inaki Williams togeda wit Bournemouth striker Antoine Semenyo.

Westham starboy Mohammed Kudus also go start dis game.

Head-to-head

Niger dey rank 125th by FIFA and dem don lose eight of dia nine competitive games.

Di last time Niger appear for Afcon na 2013 wia dem comot for group stage. Dem go hope say dis time dem fit qualify for di tournament for Morocco for 2025.

Ghana, bifor dia defeat to Angola bin dey on a three-game unbeaten streak.

Between Ghana and Niger, dem don meet each oda 14 times, wit 11 wins for di Blackstars and two defeats wit one draw.

Di last time di two teams meet for di African nations championship on 28 January 2023, Niger win 2-0.

Di oda Blackstars defeat happun on 29 July 1988 (0-3) for international friendly.

Di only draw between dis two teams happun on 17 February 1982 for di west Africa nations cup; dat game end 2-2.

Ghana get dia biggest win against di Mena of Niger for di Afcon on 15 February 1869; di Blackstars win dat game 9-1.

For coach Otto Addo, dis na redemption, for Badou Zaki, na time to begin di push to qualify for dia first Afcon since 2013.

Probable lineups

Niger possible starting XI:

Hainikoye (GK); Alhassane, Katore, Boueye, Yakubu; Oumarou (c), Moussa, Diabate; Abraham, Sosah, Goumey

Ghana possible starting XI:

Ati-Zigi (GK); Seidu, Salisu, Mumin, Lamptey; Partey (c), Ashimeru, Kudus, Semenyo; Ayew, Inaki

Di match go happum for di stade de Berkane for Morocco at 5 PM (WAT) and 4 PM Ghana time.

We go bring you live commentary of di game; make una stay wit us.

Source