Nigeria v Brazil Olympics 2024 women football preview

Asisat and Marta

Getty Images
Super Falcons go hope to get revenge against Brazil wey bin shake dem for dia last two meetings for di Olympics

Two-time silver medal team Brazil go meet wit di Super Falcons of Nigeria for dia opening game for di Olympics for Paris dis evening.

Di Super Falcons wey bin lose to England on penalties for di 2023 World Cup go hope say dem fit keep dia form for dis Olympics.

Di nine-time Africa champions dey inside ogbonge group C wit Brazil, Japan and world champions Spain.

But dia coach Randy Waldrum believe say im team need di talent to shine for Paris.

Im tok say “I like wetin I don see for dis team. Di players dey ready and we dey better condition now than last year.”

Waldrum add say “di team continue to improve since di World Cup and we go see am for di game vs Brazil, wey be very good team.”

Na 16 years be dis wey di super falcons and Brazil don meet for di Olympics – Nigeria lose 3-1 to Brazil for di Beijing Olympics.

Nigeria and Zambia be di only two African teams wey dey play for di Olympics and coach Waldrum tink say to qualify for di group stage go be dia target.

But Brazil women team coach Arthur Elias say im team get di potential to go far for dis tournament.

Elias tok say “di commitment of dis team dey high, and we gat strong players for dis difficult competition.”

Despite say di odds bin dey di favour of Brazil, Bay Fc striker and six-time African women’s player of di year, Asisat Oshoala believe say Nigeria get di chance to win medal.

Im tok say “I get confidence for dis team wit young players and we fit cause wahala for our opponents.”

“We no dey tink about say we go progress for di group stage, but I tink we fit to actually walk away wit medal,” di former Barcelona striker tok ahead of di game.

Brazil striker Adriana tok say make im teammates no loose guard for dis game vs Nigeria.

“Di first game dey crucial, we get to concentrate and focus for dis game and take am step by step.”

Brazil v Nigeria team news

Di Super Falcons qualify for dis Olympics afta dem beat Cameroon and South Africa as well as Ethiopia.

Brazil on di oda hand na di most successful team for South America.

Di Selecao qualify for di Olympics wen dem reach di final of di 2022 Copa America wia dem beat Paraguay for di semis and Colombia for dj final.

Super Falcons na di most experienced African nation wit three appearances for di Olympic Games.

Brazil v Nigeria Head-to-head

Brazil bin win Super Falcons 4-3 for extra time for di 1999 women World Cup quarterfinal wia dem beat dem 3-1 for di group stage for di 2008 Beijing Olympic Games.

Brazil get good record for di Olympics wia deM qualify for every edition of di games.

Dem also always dey progress from di group stage.

Di Selecao bin win silver medal for di games in 2004 and 2008.

Players to watch

Super Falcons get exciting young squad for dis tournament.

But sabi pipo tink say two players get di potential to impact games.

One of dem na goalkeeper Chiamaka Nnadozie.

Im be di best goalkeeper for di continent – wey get plenti confidence and stability for di Nigerian defense.

Di Paris FC goalkeeper bin shine for di World Cup last year and sabi pipo tok say im go be one of di key players for di Super Falcons.

Di oda player na six-time CAF women player of di year Asisat Oshoala wey dey play for Bay FC.

Di 29-year old sign for Bay FC early dis year from Barcelona.

Last December, im win di CAF women’s footballer of di year for December 2023.

Im win four league titles, two champions league and eight domestic cups during di five years im spend for Barcelona.

Oshoala bin play 162 games wit 117 goals for Barcelona bifor im play for Liverpool and Arsenal.

Super Falcons go dey hope say she fit to inspire dem for dis tournament.

For Brazil, dia star player Marta fit to have im last dance for dis Olympics.

Di Brazil legend go participate for im sixth Olympics.

Di 38-year-old win two silver medals for di 2004 and 2008 Olympics losing di finals on both occasions to di US women’s team.

If Marta play today, dat go be im 176th career game wia im gat 116 goals – im also be di leading goal scorer for World Cup for both men and women wit 17 goals.

Im go dey critical for Brazil wit im leadership and impact for di team.

Dis game go happun 6 PM WAT.

Source