Kenyan lawmakers pass motion to impeach Deputy President Rigathi Gachagua

Deputy President Rigathi Gachagua.

Getty Images

Kenyan lawmakers don pass one motion to impeach di Deputy President Rigathi Gachagua.

Na 281 members of parliament bin support bid, dem meet di two-thirds majority threshold requirement.

Dis na afta one long hearing process of impeachment of Gachagua wey chop accuse of different allegations including corruption, undermining di president and promoting sectarian division.

Di motion now don go di Senate, wey go act as di trial court and go make di final judgment within ten days.

Na two-thirds majority dem need for di motion to pass.

Di deputy president bin show face bifor di parliament on Tuesday and present material evidence to counter di 11 impeachment charges wey dey against am.

Oga Rigathi Gachagua bin tok say e dey innocent, claim say e be champion di interest of Kenyans.

Meanwhile, some of di MPs bin no support di impeachment of di deputy president.

Di Kirinyaga Woman representative Jane Miana bin tok say, “di motion wey dey bifor us dey frivolous, e dey baseless, e lack substance. Na nothing but shambolic political scheme to hound di truthful man for merely bein truthful.”

Di deputy minority leader of di house, Robert Mbui, bin tok say “Oga speaker, I only wish say di energy wey we dey spend here to send home one Kenyan dey used to solve di issues wey dey fail us for our education, in our roads sector, di cost of living don go too high, pipo no get jobs. Those be di tins wey dis house suppose passionately deal with”.

Di DP Rigathi Gachagua bin deny allegations wey dey against am.

E bin tok say di properties wey dey listed as di Olive Gardens Hotel and Vipingo Beach Resort belong to im late broda.

E also deny oda allegations say e dey bully and pressure state officers for contracts, diversion of funds among odas.

Gachagua stand before im kontri National Assembly to defend imsef against one impeachment motion wey di Member of Parliament (MP) wey dey represent Kibwezi West, Mwengi Mutuse bin sponsor.

Mwengi motion, wey di Speaker of Parliament Moses Wetang’ula bin officially notify di members about last week Tuesday, bin mention 11 grounds for di impeachment.

Based on di National Assembly Order Paper for Tuesday, di mover of di motion, Mwengi use at least one hour to present all di grounds.

Gauchagua don tok before say: “I no get intention of resigning from my position and I go fight until di end.” E bin promise to show for parliament to defend imsef.

For di House to impeach di deputy president, na just from dem to prove say one out of di 11 grounds or charges na true.

Di 11 grounds for dis impeachment debate include claim say di deputy president get hand for di violent protest wey bin happun three months ago.

E also claim say im get hand for corruption, dey promote tribalism and division for politics of di kontri.

During im presentation, Mwengi say di deputy president commit gross misconduct in terms of insubordination by directly contradicting di president policies and undermining cabinet decisions.

Di MP also allege say di deputy na owner of 20 companies and say e dey use some of dem commit economic crimes against di kontri.

Process to remove deputy president for Kenya

As members of di House begin debate Mwengi motion to impeach di deputy president, dis na di steps wey di kontri lawmakers must to follow according to Kenya Constitution.

  • Afta di mover and di defender of di motion don present dia arguments finish, members of di House go vote on am.
  • If 233 members of parliaments support di motion, di Speaker go send am to di Senate within 2 days.
  • But if e fail to get up to 233 votes from di MPs, den na dia dis mata go die.
  • Also, if 117 MPs reject am, di vice president go remain in power
  • If e reach Senate, within seven days, di Senate Speaker go convene sitting of di National Assembly Resolution.
  • Senate fit to decide say e go establish 11 member committee or plenary.
  • Which ever one e decide, Senate must to finish everything concerning investigation, hearing, and voting on di impeachment inside 10 days.

At least 45 Senators must to vote in favour of di impeachment charges for am to stand, or for dem to fit remove di deputy president.

Source