Wetin CAF rules tok About hosting visiting teams?

Afta Nigeria and Libyan authorities put leg for one trouser sake of di 2025 Africa Cup of Nations match day three qualifier, pipo don dey ask question about wetin be di rules.

Nigeria and Libya suppose play di second leg of di qualifier on Tuesday for di Martyrs stadium for Benghazi, but di Super Eagles call am off.

Drama happun between Nigeria and Libya wey make di Super Eagles vex to di point wey dem no gree play di match again afta Libya keep dem for Al Abraq airport for over 15 hours.

Even though e be like say di mata don cool down small, di Confederation of African football say dem dey chook eye inside di mata.

For statement dem also add say di mata dey in front of di disciplinary committee.

Pipo around di world begin chook mouth for di mata afta di Nigeria Football Federation announce say dem no go play di match again.

Pipo tink say na joke, until Super Eagles return to Nigeria on Monday evening.

Caf don also promise to sanction di team wey cause all dis kasala wey don also cause diplomatic issues between Libya and Nigeria.

Di Tunisian Pilot wey fly di Super Eagles tok how e warn di Libyan authorities eight times against diverting im flight but dem tell am say na order from above.

E say “di plane bin supposed to land for Benina, Benghazi. We even get clearance to land for Benghazi but wen we start to land dem tell us to divert to Albraq wey be almost 150 miles wey be 300 kilometres.

“E dey more far and wide sey for di East, no be even our alternate (back up) and na sometin wey no dey good.”

Wetin Caf rule tok

According to one Caf publication on guidelines for logistics to host any international match like Afcon qualifiers, Championship of African nations (Chan) Caf Champions League and Confederation cup, di host kontri must do di following

If any visiting team land late due to travel complications, several protocols dey wey dem go follow depending on how e happun and wetin make dem to arrive late.

Transportation Obligations: Di host federation (kontri) dey responsible to make sure say di visiting team dey safe.

Dem go also make sure say dem get transportation wey no go pass 200 kilometres. If di corner-corner road wy dem go follow pass 200 kilometres distance and e kon scata match preparations, Caf fit step in to reschedule di match or adjust logistical support.

Rescheduling for Force Majeure: If serious delays stop any team to reach on time or train well, e fall under “force majeure” ( unforeseeable circumstance), Caf fit reschedule di match to make sure say fair play dey.

If e happun say big kasala happun wey stop di match, di host federation (kontri) fit chop sanction if Caf find out say dem dey at fault for inadequate preparations or failure to accommodate di visiting team in good faith.

Training Ground Access: According to Caf regulations, di home team must allow di visiting team get access to dia main playing field at least once, especially on the evening of di match.

In case na artificial turf, teams dey entitled to two sessions, one scheduled for di match kick-off time.

Safety and security of visiting teams: Caf guidelines say di hosting kontri need to undertake a risk assessment with di authorities of di visiting team to

understand di kind of risks dem fit cause.

Visiting team officials dey advised to undertake a risk assessment with dia relevant authorities for dia kontri bifor dem depart to anoda kontri for dia match.

Di match organiser go coordinate with di local police to ensure di safety and

security of di visiting team supporters in relation to di provision of security for dia

hotel, provision of police protection for dia movement from dia arrival till

departures.

Why dis issues dey common for Africa football?

Dis no be di first time wey tins like dis dey happun for African football. E dey happun for both international and club levels, football journalist China Acheru tok.

E say e dey happun between two nations from different parts of di continent, especially during continental matches like Caf Champions League and Confederation.

Di ogbonge football journalist say dis na di worst im don see for im over 30 years experience wey im don dey follow football clubs travel around di continent.

Di former Media Officer for defunct Dolphins Football Club of Port Harcourt say dis kain tin dey common for Africa becos di host teams dey try to cause any kind of kasala wey go disorganise di players or di team.

“E dey happun evritime dis na wetin we dey call ‘dark arts’ for football, wia teams dey try to gain a certain advantage off di pitch ( outside of di field) wey go affect di teams (visiting team) on di pitch (inside di field of play).

“Wetin happun to di Nigerian team for Libya na about di worst I don hear about for my life.”

Oga China share some of di ‘dark arts’ im don experience for im over 30 years as sports journalist.

“I bin go Malabo (Equitorial Guinea) with Dolphins Football club for 2005 wen di hotel off di lights on di eve of di game and we sleep for darkness, all of us remove our shirts kon sleep for di balcony of di hotel becos heat too much.

I don go one hotel for Egypt wen Dolphins go play for 2005, one orchestra (live band) just show up start to perform on di eve of di game and dem play loud music till about 3am early mor-mor non of our players fit sleep.

Clubs and kontris dey do dis tins, dem fit delay you for airport for few hours, your bus fit pass di wrong road just make dem collect some of your time.”

Wetin be di solution

Di Port Harcourt based News and Sports Editor explain say, even though dis time dey happun all di time, wetin Caf fit do to stop am.

E say if Caf no use wetin happun to Nigeria teach oda African kontris example e go kontinu to happun and e fit worse pass wetin Nigeria experience in future.

Im explain say during in time as Media Officer, na sake of issues like dis dem dey carry dia own food, drinks, make dia own hotel arrangements to di point of getting dia own transportation arrangements too.

Im add say Nigeria Super Eagles own cross di line, sake of say dem no even allow dem comot from di airport for plenti hours ” so e be like abduction (kidnapping) wetin Nigeria team do as dem no gree play di game na di best”

Im tok say for Caf to end dis tin dem need to sama di kontri wey dey at fault with ‘heavy’ sanctions.

“Caf go fit take bold step to disqualify Libya? No be from only dis Afcon o but from all football related activities until di time wey Caf don dey satisfied say Libya don ready to host sporting events.”

Anoda Sports Editor, Patrick Ngwaogwu say “Wetin Caf need to do now na to match leg for ground sake of say regulations dey wey you need to meet to host a team wey dey come to your kontri for international championship.

E add say di way Caf handle dis mata wit Nigeria and Libya go determine so many tins”.

As e be so tensions dey high and all eyes dey on Caf sake of say football fan across dey world dey wait to see wetin Caf go do.

Source