‘All these accuse na mere allegations’

Di management of Air Peace Airline don react to di fresh charges US goment sama against di founder of di airline, Allen Onyema and di airline Chief of Administration and Finance, Ejiroghene Eghagha.

For one statement di management post on Sunday on dia X account, e say di charges na “mere allegations as Oga Onyema and Madam Eghagha remain innocent.”

On Friday, 10 October, di US Department of Justice bin release one statement wia dem charge Oga Allen Onyema wit new charges, say e dey obstruct justice, as e submit fake documents give goment to stop one ongoing federal investigation into im mata.

Di US goment also accuse Madam Ejiroghene Eghagha, say e follow for di obstruction scheme, and she also dey involved for one earlier bank fraud charges.

Di Chief Executive of Air Peace and im Chief of Administration and Finance don dey under investigation since 2019 on top accuse of alleged fraud and money laundering.

61-year-old Oga Onyema dey charged wit 27 counts of money laundering, wey involve more dan $20 million, and 42-year-old Madam Eghagha dey face accuse of one count of aggravated identity theft, according to di announcement of di US Department of Justice.

Wetin be di charges US get against Allen Onyema

Di US Department of Justice for di latest statement dem release accuse di founder of di Nigeria Airline of additional crimes.

On October 8, 2024, di justice department bin charge dem wit one superseding indictment alleging additional count of obstruction of justice and one count of conspiracy to obstruct justice.

“Afta e allegedly use im airline company as cover to commit fraud for di United States’ banking system, Onyema, plus im co-defendant, allegedly commit additional crimes of fraud for one failed attempt to scata goment investigation of im conduct,” U.S. Attorney Ryan K. Buchanan tok.

Oga Onyema also chop accuse say e use di US banking system hide di source of im wealth.

“Allegedly, Onyema and im accomplices use magomago hide dia source of ill-gotten wealth for U.S. banking system,” di Assistant Special Agent in Charge Lisa Fontanette, Internal Revenue Service – Criminal Investigation Atlanta Field Office tok.

She add say di new charges na to neutralize threats to di United States from criminal organizations and to pursue those wey wan exploit dia kontri financial system and any efforts to cover up illegal activity.

For 2019, di US Department for Justice bin charge Oga Onyema and Madam Eghagha wit accuse wey include;

  • One count of conspiracy to commit bank fraud
  • Three counts of bank fraud
  • One count of conspiracy to commit credit application fraud
  • Three counts of credit application fraud

Also dem charge Oga Onyema wit 27 counts of money laundering, and Eghagha bin dey charged wit one count of aggravated identity theft.

Our CEO consistently cooperate wit authorities – Air Peace

Management of Air Peace for dia reaction say dia leader and im legal team don consistently cooperate wit US authorities throughout dis process.

“Our legal team dey fully engaged wit di mata and dey work tirelessly to ensure say justice prevail,” di management tok for statement.

Dem add say dem dey confident say through due process, di truth go come out and dia CEO plus di co-defendant go dey free.

Allen Onyema na di oga kpatapata of Nigeria Airlines Air peace wey start for 2013.

E come from Mbosi town for Ihiala Local Government Area of Anambra State, South East region of Nigeria.

E study Law for University of Ibadan and attend Nigerian Law School between 1987/88 before dem call to bar for 1989.

For 2019, Nigerians on social media name am ‘Man of di Year’, sake of im act of “patriotism”.

Dat year na wen Nigerians bin dey face Xenophobic attack for South Africa.

Oga Onyeama use im airline carri 188 pipo return to Nigeria afta di xenophobic attack on foreign business for South Africa.

Source