Benin vs Nigeria 2026 World Cup qualifier starting line up

Benin and Nigeria go face diasef today

Getty Images

Di Super Eagles of Nigeria go play against di Cheetahs of Benin Republic for di 2026 World Cup qualifier game on Monday.

Nigeria currently dey fifth position in Group C and dem dey dey expected to secure dia first win of di qualifying campaign against Benin afta dem draw wit South Africa.

Di Super Eagles draw dia initial three matches against Lesotho, Zimbabwe, and South Africa.

Against South Africa for di Godwin Akpabio Stadium, Uyo Akwa Ibom State, dem play 1-1.

Finidi George no hide im disappointment wit di draw against Bafana Bafana of South Africa and dis na part of im first assignment since im take over.

Finidi dey hope to qualify for di World Cup afta di game for Benin.

“I no dey shake, I dey relaxed, we know wetin dey at stake, we know say we gatz qualify (for di World Cup), but dat wan no mean say we go run helter skelter becos of di draw,” di coach tok.

“We gatz get our heads up and work for di next game (Benin).”

Di match go happun on Monday 10 June 2024 by 5pm Nigerian time for Houphouet Boigny Stadium, Abidjan, Ivory Coast.

Currently, Lesotho dey lead di Group C wit Rwanda for second position. Nigeria dey 5th position but dem go face Benin for dia next game while South Africa wey dey 4th position go face Zimbabwe wey dey bottom of di group.

If Nigeria win dis game against Benin Republic, dem go fit lead di Group C ahead of Lesotho. E go revive dia World Cup hope and wia dem go appear next.

Even Benin neva get a good start for di qualifier.

Di Benin Republic team dey coached by ex-Super Eagles boss Gernot Rohr. Dem no win dia opening match against South Africa and draw against Lesotho.

Benin manage to secure a 1-0 victory over Rwanda for dia last game.

Benin vs Nigeria line up

Benin starting XI: Dandjinou, D’ Almeida, Dodo, Dossou, Hountondji, Imourane, Kiki, Moumini, Mounie, Olaitan, Tijani

Subs: Ahlinvi,Ahouangbo, Allagbe, Amoussou, Dossou, Fassinou, Karim, Roche, Sankamao, Tchetchao, Tosin

Nigeria starting XI: Nwabali, Ajayi, Bassey, Tanimu, Osayi- Samuel, Onyedika, Iwobi, Ndidi, Chukwueze, Lookman, Moffi

Subs:Iheanacho, Boniface, Onuachu, Abdulahi, Dele- Bashiru, Onyeka, Awaziem, Olawoyin, Igboke, Ismaila, Oloye, Ojo

Head-to-Head

Nigeria dey always dominate against Benin Republic afta dem win 13 of dia 16 games, wit two draws and one loss.

Di Super Eagles win dia last three matches against Benin while di only victory by Benin na for 2017.

Source